Oliver De Coque

From Wikipedia

Oliver Sunday Akanite (14 April 1947 - 20 June 2008) wey dem dey also kol Oliver De Coque na Naijá pesin wey dey play guitar an rekod muzik.

How im tek stat life an how e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born De Coque for Ezinifite wey dey inside Anambra Stet for Naijá for 1947. Im papa an mama na Igbo pipul. Im stat to dey play muzik wen e dey 11 years an na one pesin wey kom from Congo wey dey play guitar tich am. De Coque bin dey wok wit Sunny Agaga wey dey play juju muzik an Jacob Oluwale wen im be boy. Dem begin sabi am everiwia for di wold afta im do sho for London for 1973 an im wok for guitar dey part of Prince Nico Mbarga album wey e kol Sweet Mother for 1977. E komot im first albom, Messiah Messiah for 1977. All di albom wey De Coque rekod na· 93. Plenti of im songs wey im rekod na ogene style, as e blend modan and tradisiona Igbo saund togeda. Som of im singu songs na "People's Club of Nigeria", "Nempi Social Club", "Biri Ka Mbiri", "One Enwe", "Nnukwu Mmanwu" and "Identity". Di Identity uz 2 weeks for Radio Nigeria top ten for 1981. Apat from im wok, De Coque dey alweyz play wit Igede International Band, wey im broda Eugene be dia oga.

Im Pasona Life And How E Tek Die[chenj-am | chenj-am for orijin]

De Coque get Four boyz wey be: Solar De Coque, Safin De Coque (Darlington Akanite), Edu De Coque (Chinedu Akanite), and Ikenna Akanite.[1]Dem giv De Coque Degree for muzik for University of New Orleans.[2]. De Coque die for June 20 2008 afta e bin get di sicknes wey Dem dey kol cardiac arrest.[1]. Im pikin tok sey De Coque don ready sey im want paform for 2008 bot e don Plan sey e go go for medika advise for di month afta im don die. [3]

Wia Wi Si Pruf[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. 1.0 1.1 https://www.sunnewsonline.com/being-oliver-the-coques-son-has-been-demanding-yet-rewarding/
  2. .https://www.bbc.com/pidgin/tori-56715627
  3. https://nationaldailyng.com/%ef%bf%bchow-oliver-de-coque-most-kept-secret-took-him-to-early-grave/