Olga Ozarovskaya

From Wikipedia

Olga Erastovna Ozarovskaya (dey bon am in 1874 an e kpai in 1933) na Russian pesin wey de stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way, e na tori-tella, raita an pesin wey dey kip tradishonal tori wey pipul dey tok. Ozarovskaya don poblish some Norta Russian tradishonal tori buks. Na Ozarovskaya bi di fest wuman wey wan wok for govamet in Russia an di fest wuman wey du wok for sayens akedemik in Russian Empaya. Ozarovskaya don wok wit Russian tradishonal tori-tella Mariya Krivopolenova

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for St. Petersburg wey de Russia Empaya dey tek bon Olga Erastovna Von Ozarovskaya. E papa nem na Erast Ozarovsky an e mama nem na Varvara Petrovna Von Ozarovsky. Ozarovskaya papa na Russia Souja bifor. Ozarovskaya get two brodas Alexander Erastovich Ozarovskaya an Yuri Erastovich Ozarovsky. Alexander na souja an Yuri bikom aktor an e leta bi di daretor of di Alexandrinsky Tihata. Ozarovskaya rid Kemistri an get e digri in St. Petersburg Yunivasiti ( dey chenj di nem to Saint Petersburg State University). In 1897, Ozarovskaya finish from "Higher Women's Courses" in Petersburg wey e kolet digri satifiket in Matimatis. In di 90s, araund 1907, Ozarovskaya stat to pafom for smol smol an lokal ples. E pak go Moscow an fom di "Living Word Studio" in 1911. Bitwin 1915 go rish 1925, Ozarovskaya travu to Norta Russia four time bikos e wan kolet an kip Norta tradishonal tori an song. Wen Ozarovskaya travu gi Arkhangelsk Governorate in 1915, e met Mariya Krivopolenova an e gri mek Mariya folo am go Moscow so dat Mariya go fit pafom in Moscow. Ozarovskaya stil rait an intaprit di wok of Krivopolenova's an Dis tin wey e du mek am de popular wel wel.

Ozarovskaya kpai on June 12, 1933 in Frunze (di niu nem na Bishkek), Kirghiz ASSR, Soviet Union. Meni of di tin wey e kip dey St. Petersburg inside di Pushkin State Museum of Fine Arts.