Olamide Faison

From Wikipedia

Olamide Aladejobi Patrick Alexander Faison (dem bon am for July 21, 1983) na Amerika pesin wey dey akt fim an dey sing muzik.

How e tek stat life an wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am for New York City. Faison akt as Miles Robinson insaid di smol smol pikin fim Sesame Street.E join di fim for 2003. Na e bi di nomba three aktor wey akt di pat of Miles Robinson afta Miles Orman an Imani Patterson don akt di pat bifor.

How e tek sing muzik[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Olamide bi di pesin wey dey sing an plai gita for di Universal/Motown grup wey dem dey kol Imajin. As e dey akt for Sesame Street, e stil dey yuz smol taim dey pratis for di hol wey dey di Kaufman Astoria Studios. For 2010, Olamide sing som pat for 'Skybourne' wey dey Currensy albom wey komot for 2010, di albom nem na Pilot Talk.

Tori of e laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Olamide get sinio broda, e nem na Donald Faison an e akt for Juice Clueless, One 1996 komedi fim an one fim wey dem dey kol Scrub. Olamide na Yoruba nem an wetin e men na "my moni an propati don kom". Olamide foma gel frend na Natalie Nunn wey akt for Bad Girls Clubs.