Olajide Fashikun

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Olajide Fashikun (dem bon am September 14, 1965 an e kpai January 27, 2019) wey pipul no wel wel as Olajide Ayodeji Fashikun, na di late Naija jonalis wey dem harest for November 2011 ova di tori wey e rait wey tok of koropshon wey dey hapun for the Naija Futbol Federashon.[1] Fashikun bi di bifor editor of di Nashona Akord Niuspepa[1] and di poblisha of Gong News onti e kpai for January 2019.[2] For 15 October 2019, Isaiah Ogedegbe tok beta tins abaut Fashikun afta e kpai and e kol Fashikun "a no-nonsense jonalis, a sports ripota wey nobody fit bribe".[2] Dem sabi Fashikun wel wel for di way e dey tok an fight mek magomago no dey Naija sports.[3] Dem also sabi am as di persin wey stat di "Adopt an athlete" hidiya to helep upkoming athletes wit moni to go ogbonge kompitishons.[3] [4]

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Kaduna wey de Naija dem bon Olajide Fashikun on di 14 September, 1965.[5][6][7]

E stat as all round sportsman wey pley futbol, handbol, volibol, basketbol and e win vitori for im kontri.[7]

Fashikun pley handbol for Naija (1979-1999) wen e ritaya from intanashona dutis.[5] E pley futbol for Zabgai of Bauchi (1984); El-Kanemi Wariors of Maiduguri (1985); Zamelek of Egypt (1986-1988) wen injuri mek am comot.[5][7]

E bi Naija junior 200m wina and rekod hoda for 1979.[5] E bi di yongest pleya for Naija handbol men nashona tim wey win di Afrikan Nashons Kup for 1979.[5][7]

Medas[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fashikun don win gold meda at Afrikan Nashons Kup for Legos, Naija for 1980; gold meda at Afrikan Nashons Kup for Baushi, Naija for 1984; gold meda at NIPOGA for 1985 for Kaduna, Naija; bronze meda at Naija Univasitis Games Asosiashon (NUGA) for 1988 for Kalaba, Naija; gold meda at NUGA for 1998 for Kano, Naija.[5][6]

Buk[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Issues in Nigerian Social Work Administration[8]

Posishons[chenj-am | chenj-am for orijin]

E bi di bifor editor of di Nashona Akord Niuspepa,[1] di sports editor of di Herald Niuspepa and di senior sports ripota of ThisDay Niuspepa.[4] E bi also di managing editor of Gong News[2][4][6][7] and pipo sabi am for im koret ripots.[5] E don bi leshora bifor for di Kwara State Polytechnic and e na di bifor chairmo of di Sports Raitas Asosiashon of Naija, Kwara State rejon.[4][7]

Fashikun bi di bifor daretor, Sports Development and Marketing wit di Naija Sports Development Fund Incorporated.[5][9]

How e tek kpai an e beriha[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fashikun kpai one Sunday morning for 27 January 2019 for di Fedra Medkol Senta, Jabi for Abuja, Naija afta a brief siknes.[4][7][10] E bi 54 years old.[4]


Dem beri am for Wednesday, 30 January 2019 for di ples wie e kom fom, Obbo-Aiyegunle wey dey for Ekiti Loka Gofment Area of Kwara Stet, Naija.[11] E dai leave im old mama, wife and four pikins.[12]

For 25 March 2023, Isaiah Ogedegbe once again prez Fashikun for im atikul and e tok say, "E bi sports jonalis bifor wey bin give sports jonalisim a niu definishon, di man wit di acidik biro wey bin rait truth to pawa. E bin dey tok im mind evri taim, yuzing im ogbonge websait Gong Nius to expose wayo and koropshon".[13]

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. 1.0 1.1 1.2 Smith, Karen (15 November 2011). "Nigeria journalist arrested, faces libel suit over soccer stories". Cable News Network. Retrieved 1 March 2023.
  2. 2.0 2.1 2.2 Ogedegbe, Isaiah (15 October 2019). "Olajide Fashikun: What I Remember Him For -By Isaiah Ogedegbe". Opinion Nigeria. Retrieved 1 March 2023.
  3. 3.0 3.1 Olamide, Ayo (28 January 2022). "TRIBUTE: Remembering Jide Fashikun Dogged Nigerian Sports Anti- Corruption Crusader". Gong News. Retrieved 1 March 2023.
  4. 4.0 4.1 4.2 4.3 4.4 4.5 Odunsi, Wale (27 January 2019). "Renowned journalist, Jide Fashikun is dead". Daily Post. Retrieved 1 March 2023.
  5. 5.0 5.1 5.2 5.3 5.4 5.5 5.6 5.7 "Fashikun, Olajide Ayodeji". NigerianWiki.com.
  6. 6.0 6.1 6.2 Kuti, Dare (25 September 2018). "Olajide Fashikun: I got my first new pair of trainers at Zamalek". ACLSports.com. Retrieved 1 March 2023.
  7. 7.0 7.1 7.2 7.3 7.4 7.5 7.6 "HFN Mourns Former National Handball Player Olajide Fashikun". Titan Sports. 28 January 2019. Retrieved 1 March 2023.
  8. Fashikun, Olajide Ayodeji (2006). Issues in Nigerian Social Work Administration. 978-978-809-013-7.
  9. "Golden Eaglet captain and Adokiye: The Insanity in a Newspaper Columnist-by Olajide Fashikun". The Nigerian Voice. 7 November 2009. Retrieved 1 March 2023.
  10. Babalola, Oluwatomiwa (27 January 2019). "Jide Fashikun, top Nigerian Sports Journalist dies in Abuja". Legit.ng. Retrieved 19 March 2023.
  11. Atolagbe, Femi (1 February 2019). "ODSG, others pay last respect to Olajide Fashikun". The Hope Newspaper. Retrieved 1 March 2023.
  12. Shittu, Hammed (31 January 2019). "Late Fashikun Laid to Rest at Obbo Aiyegunle". ThisDay Newspaper. Retrieved 1 March 2023.
  13. Ogedegbe, Isaiah (25 March 2023). "Two Sports Journalists And Their Contribution To Sports Development In Nigeria -By Isaiah Ogedegbe". Opinion Nigeria. Retrieved 25 March 2023.