Ola Belle Reed

From Wikipedia

Ola Belle Reed (dey bon am August 18, 1916 an e kpai on August 16, 2002) na Amerika wuman wey dey sing Appalachian tradishonal muzik. E na song-raita an e sabi play di muzik instrumet wey bi like ginta kol banjo.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Grassy Creek, Ashe County, North Carolina dey bon Reed on August 18, 1916. Di nem wey de e birth satifiket na Ola Wave Campbell. Reed papa nem na Arthur Campbell an e mama nem na Ellen Campbell (e mama nem bifor marej na Osborne). Reed na nomba four pikin out of di thirteen pikin-dem wey e peret bon. Reed from smol sabi di clawhammer-style banjo as e dey play am wen e famili dey sing di old song wey pipul araund di montain aria dey sing. Reed mama famili-dem an Reed mama famili-dem too sabi di banjo instrumet wel wel. Reed gra-pa wey bon e mama wey e nem na Alexander Campbell sabi di violin wel. Reed papa sef sabi play violin, banjo, ginta, an organ wel too. Na Reed onku Dockery Campbell pipul biliv sey na e tish Reed how to play di "clawhammer-style banjo". From Reed mama side, Bob Ingraham dey tish for singin skul an e onku Herb Osborne sabi sing oda pipul song wel. Na Reed mama an gra-ma tish Reed how to sing song.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Reed don bi tineja, e famili pak go Souta Pennsylvania. In di mid-1930s, Reed join di "The North Carolina Ridge Runners". Leta, e fom a band kol "The New River Boys and Girls" wit e broda Alex Campbell. Alex Campbell leta go opun di "New River Ranch in Rising Sun in Maryland. Meni muzishan kom di ples kom pafom onto 1958 wen dey skata di ples. Dey leta bi di "House band" an dey kom dey oafom live sho at anoda muzik park kol "Sunset Park" in West Grove, Pennsylvania.

Reed song dey always tok abaut life an tradishon of Appalachian pipul.Odas muzishan don ripit e song wey de popular. Del McCoury, Tim O'Brien, an Marty Stuart don sing one of e song wey de popular "High on the mountain". Del McCoury as wel as Tim O'Brien don sing anoda of e song "I've Endured". Dey nem one muzik grup wey de New York Ollabelle bikos of Reed.

Dem dey du one festival evri year Di "annual Ola Belle Reed Muzik Festival in [Lansing, North Carolina]] to honor Reed Reed life an muzik.