Okada (motorcycle taxi)

From Wikipedia
Okada
mode of transport
Has usemotorcycle taxi, taxi service Chenj-am
Official nameOkada Chenj-am
Country of originNaija Chenj-am

Okada (or Achaba, Going, Inaga[1]) na motorcycle wey dey carry passenger, e dey common for Naija and other African kontris-dem.[2]

Okada or motorcycle taxi dey popular for some oda West African kontris[3] like Togo (dem call am oléyia), Benin (dem call am zémidjans), Burkina Faso, Liberia (dem call am phen-phen), Ghana[4] and Sierra Leone.[5]

Etymolọgi[chenj-am | chenj-am for orijin]

Commercial motorcycles for Nigeria wey dem dey use carry passenger wey dem nickname "okada" get origin from Okada Air (wey don close) wey be airline wey get the same name as the owner, Chief Gabriel Igbinedion hometown. Dem call am okada because e fit waka well well pass for Lagos heavy traffic and dem fit carry passenger go their destination quick quick like how the airline dey take fly people. The irony of using airline name as nickname for commercial motorcyclists and because everybody sabi Okada Air, na him make the name okada still dey use even after the airline wey dem take the name from don close, wey many Nigerians no longer remember. For January 2020, "okada" word join the 28 other widely used Nigerian words wey dem add to Oxford English Dictionary for the January updates.[6]

Naija society[chenj-am | chenj-am for orijin]

Okada for Kano, Naija

Taxi and bus wey dey Nigeria no dey ehn, and traffic and bad roads na everywhere. Okada na im people dey use for cities like Lagos, whether na businessmen, government workers or students, so dat dem go fit pass go their destinations even for traffic. Okada dey fit pass roads wey cars and buses no fit pass, especially for villages and areas wey no get access. The main reason why okada dey so popular na because of their low cost for operators, and the fact say dem dey use fuel small, wey e dey important well well for Nigeria wen fuel no dey plenty.

Riding for okada dey cost pass public transport. Tourists and people wey dey live for the place don talk say the experience wey dey come with okada na different level.[7]

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. "The impact of Inaga ban on students". thenationonlineng.com. The Nation (Lagos), Thursday, 18 June 2009. Retrieved 2009-12-27.
  2. Gold, Michael; Rashbaum, William K.; Slotnik, Daniel E. (15 July 2020). "Dismemberment Killing of Tech C.E.O. 'Looks Like Professional Job'". The New York Times. Retrieved 16 July 2020. Motorcycle taxis, called okada in Nigeria, have long been popular in Lagos and many other African cities as a way to circumvent traffic jams.
  3. Ezeibe, Nzeadibe, Ali, Udeogu, Nwankwo and Ogbodo (2017). "Work on wheels: collective organising of motorcycle taxis in Nigerian cities". International Development Planning Review. 39 (3): 249–273. doi:10.3828/idpr.2017.10.{{cite journal}}: CS1 maint: multiple names: authors list (link)
  4. Annang, Evans. "NPP govt will never legalize okada in Ghana - Dr. Bawumia". Pulse Ghana. Retrieved 17 September 2020.
  5. Mbella Mouelle, Stephanie Laura (2014). "Complex Causality between Transportation and Human Security: A Special Focus on the City of Douala, Cameroon". Templet:ProQuest. {{cite journal}}: Cite journal requires |journal= (help)
  6. Augoye, Jayne (21 January 2020). "'Okada', 'Kannywood', 27 other Nigerian words added to Oxford Dictionaries". premiumtimesng.com/ - Premium Times News. Retrieved 2020-02-15.
  7. Cervero, R: "Informal Transport in the Developing World", 2005