Oghara

From Wikipedia

Oghara na town wey dey for Ethiope West Lokal Guvment Aria of Delta Stet in Naijá. Di town na house for Urhobo ethnic grup of Delta Stet. Pipul no di town for deir rich meniral resources. Oghara pipul wok na farm wok an to dey tek kia of Anima.Dey sabi mek robba, kasava, palm trie, plantain, banana, yam an fish making. Pipul stil no di town for produkshion of crude oil.Anoda nem for Ogbara na Oghara. Di town get bondiries to di East with Mosogar Kindom wey dey riva Ethiope go rich south for sapele lokal Gofment Aria wey adjoin tributary for Ethiope riva to di North for Edo stet near di Osiomo/ologbo rivas and to di South West for koko for warri North lokal Gofment Aria of Delta stet. Populashion for Oghara go rich abaut 400000. Pipul wey get Oghara town na two famili-dem wey deir nem na Ogharefe and Oghareki. Ogharefe tribe get oda smol smol famili or quarters like Edjemwoyavwen, Adagboyerin, Ijomi, Otefe, an Ovade.Oghareki tribe get di smol smol famili wey mek up di town Udurhie an Uduaka pat. Oghara pipul dey share hu go bi di rula bitwin Ogharefe-dem an Oghareki-dem. Di Iyasere wey bi di tok tok pésin for di king and sekond pésin wey get pawa pass tok sey abeg make una know sey dis posishion dey muve bitwin di two famili an di tok tok pesin no dey kom from di tribe wey dey produse di next king for Oghara kindom. Ogharefe an Oghareki pipul-dem dey do chieftaincy system and dem get independent traditional councils and community halls(Oguedion) wey be say Unugbrogodo dat is traditional prime minister na im be di head of di komuniti. Di king of di kindom na Noble Eshemitan wey get titles like Orefe 111 an di kurrent Unugbrodo of Ogharefe clan na im be di high chief Stephen Egbivwie of di Ogbojere lineaga from Adegboyerin. Oghara get plenti makets wey som of Dem na Ogharefe maket, Oghareki maket, Oghara junction maket, Ugbenu maket and di cattle maket with oders.

Tins wey dey Oghara[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oghara dey ples whey Gofment porperti dey like di Nigerian Naval Logistics Headquarters for South, Mopol 51 Base for Nigerian Police Force and Local Government Council headquarters. Di town na hause for different pan ocean flow station and Gas plant like Pamol, precos and Jk.

Festivals[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di pipul for Ogharefe get smol smol clan for Oghara kingdom dem dey du di Iyerin festival evri year for dem to rememba di kustoms and tradishion for Ogharefe pipul for Oghara kingdom.

Popula Pipul Wey Kom From Oghara[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Chief James Onenafe Ibori.
  • Late Otubu itse omene.
  • Late mathew Agbedia.
  • Noble Eshemitan.
  • High Chief Stephen Egbivwie.
  • Robert Okoro.
  • Air Commodore Broderick O. Akpotaire(Rtd)
  • Engr Jeremiah Sakpoba Eghweree.
  • Ogheneruonah Charles.
  • Sir Nathaniel Sakpoba.
  • Hon Moses Ogbe
  • Hon Isaac Udju
  • Hon Solomon Golley