Odera Olivia Orji

From Wikipedia

Odera Olivia Orji (na Olivia Chidera Orji bi di nem wey ha parent giv am) Naijá aktres, fine dareto an fim podusa.

How Shi Stat Life An Go Skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Odera for Ihiala, Anambra Stet but wey shi gro na for Enugu, wey dey Enugu Stet for South-East Naijá. Shi finish ha basic edukashion for Chiazo Nursery and Primary School an ha sekondiri skul edukashion for Command Day Secondary School. Shi get Bachelor Degree for Theatre and Film Studies for University of Nigeria, Nsukka.

How E Tek Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Odera Olivia Orji's akting wok stat wen shi akt for di fim we di nem na "Last Flight to Abuja" for 2012. Shi kom dey popula afta shi akt as "Peace" for one MNET Africa Telivision Series Jemeji. Shi don stil akt for fim-dem like Obsession, The Father, Blue, Fifty, Kayanmata, Bedroom Points, an Just a Fling. For 2018, dem selekt am for Best of Nollywood Awards for Best Kiss in a movi alongside Mawuli Gavor.

Shi don stil do oda wok asaid fom akting. Olivia de wok as Media and Creative Associate for Eureka Media Services and Assistant Director, Content Development, Mindworks Story Consultancy and Productions.