Obudu Mountain Resort

From Wikipedia

Obudu Mountain Resort (wey i bifor bifor men na Obudu Cattle Ranch) na one ogbonge relaxashion ples for Obudu Plateau inside Cross River Stet, Naijá.

Tori of di ples[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na M. McCaughley, one Oyibo man fom Scotland bi di fest man to waka round di montain in 1949 an e join hand wit Mr. Hugh Jones an Dr. Crawfield to stat Obudu Cattle Ranch for 1951.

Na Sins 2005 wey dem don put kebu waya wey dey klimb 870 metres (2,850 ft) fom di bottom go rish di top of di plateau an dis one dey giv visitors koret view for di ples.

Di Lokashion Of Di Ples[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di ples dey on top Obudu Plateau, wey dey near Cameroon border for northeast pat of kross Riva Stet wey be around 110 kilometer (68 mi) east of the town of Ogoja an 65 kilometers (40 mi) fom di town of Obudu inside Obanliku Lokal Govment Aria of kross Riva Stet. Di Ples dey about 30 minutes drive fom Obudu town kom dey about 332 kilometers (206 mi) drive fom kalabar, wey bi di kapital of kross Riva Stet Transport

Dem get Charter air service wey dey reach Bebi Airport wey dey bitwin Di vilej of Obudu an di resort bot di airstrip no kom wok again an Di kable kar self don spoil for som time now.

Weda of di ples[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di weda for di Ranch bi semi-temperate mountain weda, wey bi di jeneral welda condishon on top Obudu Plateau bikos di ples dey about 1,600 metres (5,200 ft) elivashon.

Ples Wey Pipul Like To Go Enjoi[chenj-am | chenj-am for orijin]

For somtime now, bikos sey di Govment of kross-Riva Stet don divelop facilities for di ranch wey don mek di ranch dey popula as tourist an relasashon ples for Naijá, plenti plenti Naija pipul an internashional tourist don dey waka enta di ranch go enjoi demself as di klimate for di ples dey kul pass odas region for Naija.