Obiaruku

From Wikipedia

Obiaruku na one ples for Ukwuani town inside Delta State for Naijá. Na Eziokpor an Umuedu pipul fest stey for Obiaruku so na dem be di original Obiaruku pipul for inside Delta Stet. Obiaruku na di headquarter of Ukwuani lokal Gofment aria (LGA) Delta Stet Naijá. Obiaruku na one of di majo house for Ukwuani (akashiada) pipul. Di Okpalauku for Obiaruku na im bi di pesin wey old pass for the hole town. Obiaruku get meni communiti an smol smol communiti wey dem dey kol quarters and dey bi Okuzu, Umusume, Ogbeaka, Ogwezi and meni like dat. Every communiti quarters get Okpalauku wey bi di oldest male as di tradishional head of di communiti[1]

Di Okpalauku get e own kabinet and na di chief (inotu) form di kabinet.Som of di Shief-dem na Onotu-uku (tradishional prime minista) Ugo (speaka) Onueze like dat. Dem get general assembly for tradishional rulas wit di oldest Okpala-uku as di Okpala-uku generally.

Were Wí Gada Di Tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Amaize, Emma (2005-05-28). "Story that touches the heart: Families rendered homeless as youths set villages ablaze". Online Nigeria. Devace Nigeria. Retrieved 2007-10-07.