Obi Cubana

From Wikipedia

Obinna "Obi" Iyiegbu ( dey bon am 12 April 1975) wey pipo sabi wel wel as Obi Cubana na Naija biznes-man, Entatena, an pesin wey like to dash pipo moni an propati. Na Obi Cubana dey kontro di "Cubana Group" kompini.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Anambra Stet dey bon Obi Cubana on 12 April 1975. Obi Cubana mama nem na Ezinne Iyiegbu. Obi Cubana kom from Oba wey de Idemili South Lokal Govamet in Anambra Stet.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Obi Cubana go Sentral Pamari Skul. For e sekondiri skul, e go Dennis Memorial Gramma Skul. Obi Cubana go rid Politikal Sayens for di Yunivasiti of Nigeria, Nsukka. Na in 1998 e finish from di Yunivasiti. On 26 November 2022, Enugu State University of Technology give am Honorari Doctorate.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Obi Cubana na bi fonda an oga patapata of di Cubana Group. Obi Cubana start e bizness in 2006 wen e opun one night klub kol Ibiza klub in Abuja. For 2009, Obi Cubana opun one hospitaliti klub kol Cubana in Owerri for Imo Stet. Oda ples wey Obi Cubana dey kontro bi:

  • Opium By Cubana, Owerri
  • The Grind by Cubana, Legos
  • Montana by Cubana, Legos
  • Pablo by Cubana, Legos
  • Cubana Signature, Abuja
  • Puzzo by Cubana, Abuja
  • Caledonian Suites, Abuja
  • Crave by Cubana, Abuja
  • Hustle and Bustle, Abuja
  • Grand Cubana Hotels, Abuja
  • Cubana Gustavo, Enugu

Awod-dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Afrika Canada Invest Summit Award, 2022
  • Democracy Entrepreneur of the Year at the Democracy Heroes Awards in 2018
  • Special Leadership Award from Rightville School, 2017
  • Ghana-Nigeria Achievers Award 2017 as Inspiring Personality Award, 2017
  • Northern Nigeria Peace Summit/Award 2017 as Northern Nigeria Peace Builder of the year 2017
  • Young entrepreneur of the year, 2016