Oba C. D. Akran

From Wikipedia

Oba Claudius Dosa Akran, na foma Naijá Politishian an foma tradishional rula for Badagry wey dey Lagos Stet Naijá.Na Akran dey go tok for Badagry pipul for Gofment paliment in 1951. Di nem of e taitu as king na Alolu Jiwa II of Jegba.Akran na memba of Action Congress bifor Naijá get indipendence an e na Minista for Lokal Gofment an Economik Plannin fom 1962 to 1996. Dem bon Akran for 1899 into di Kopon famili, an di Kopon famili dey wok as di head of Jegba quaters for Badagry. Di katolik priest dat time by force mek Akran go skul.Im papa kom send am go St Gregory's College for Obalende an e Kom finish im sekondri skul for King's College. For plenti years, e wok for di Ples wey pipul dey yuz send message an leta go meet anoda pesin for far ples. Im stat di wok for 1926, e kom komot for 1947. As im papa die for 1946, dem chuz am to bi di lida for Jegba quarters for 1948 an dem mek am Oba Akran of Badagry for 1950. Im fest join di pipul wey dey di Badagry Town kounsu and Egun-Awori Native Authority, e later bi di oga pata-pata for dis grop. Akran du evritin so dat dey go opun Badagry Grammar School for 1955 wey be di fest sekondri skul for Badagry an oda beta-beta tins like fine-fine ples for Badagry like wetin pipul fit kom yuz dey send message an leta go meet anoda pesin for far place, e stil mek sure sey dem kárí light kom Badagry an stil du beta-beta road.