Norma Waterson

From Wikipedia

Norma Christine Waterson MBE (dem bon am 15 August 1939 an shi kpai 30 January 2022) na Oyinbo musik shi dey sing an shi dey rait song sef. Plenti pipul sabi am as one of The Watersons memba, na grup wey dey uze music tok abaut dia Oyinbo kolsho. Oda memba for di grup na Mike Waterson an dia sista Lal Waterson, dia famili memba John Harrison, na leta wen di grup don dey big im hosband Martin Carthy join dem.

Hau shi tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Hull, East Lading of Yorkshire dem bon Waterson, bikos dem no get mama an papa wen dey smol na dia dey sta wit dia broda an sista Mike an Lal, na for di persin wey bi like dia mama, Elza Ward Dem sta, wey get shop for sekond Wod War time, shi kom fom Irish Gypsy famili. Shi tok sey im mama sabi sing wel wel an na fom am shi tek len hau to sing. Dey get one broda wey dey wit Pit Band, one of dia broda Sabi pley banjo an organ. Dia papa sabi pley guitar an banjo.

The Watersons[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na band wey stat for 1960s wit memba Norma, broda Mike, an sista Elaine wey dem sabi as Lal, dia famili John Harrison fom Kingston High School. Dem dey pley difren song bifor but na song abaut dia kolsho dem leta dey du. Dem Sabi Dem as "the Folksons". Dia fest rekodin na for di Topic Records, dia fest album frost an fire Dem du di two for 1965, Frost an fire kolet awod of di Melody Maker Album of di year. Dey kon rilis The Watersons and Yorkshire Garland in 1966. Di Watersons grup skata in 1968, wen Norma go wok as Dj for radio station insaid Montserrat. Shi sta dia for four years an wok as DJ for radio Antilles.

Di grup kom togeda again in 1972, Bernie Vikers Kon dey du John Harrison role. Insaid dat sem year dem du music for Alan Plater TV play for today, "The Land of Green Ginger", wey dem film for Hull, an e dey stil film som insaid Bullbell Folk club. Dem cheng Vickers wit Waterson's hosband, Martin Carthy. Wit di cheng wey dem du, dey kon du Pence an Spice Ale (1975), Sound,Sound of Instrument of Joy (1977), an Green Fields (1981).

Mike Waterson's daugta Racheal Waterson, replas Lal wey komot bikos e no too well for insaid 1980's, but stil dey folo dem sing wit di grup wen Lal kom bak. Hol di five persin dey sing togeda for di late 1980s an rekod song for BBC Andy Kershaw show for August.1986. In 1987, di grup wok wit Swan Arcade to stat Blue Murder. The Watersons cheng, Kon get Waterson daugta Eliza Carthy, Anne Waterson, Jill Pidd an Maria Gillholey for difren times, but no bi hol di time dem du rekodin.

Lal Waterson kpai in 1998, by di stat of 1990s, Carthy, Waterson an dia daugta Eliza don fom Waterson: Carthy grup. Di Watersons no Kon dey pley live lik bifor again, but dey kom togeda for Festival an som speshial event, dem dey kol Dem di "The Waterson Family". Dem du "A Mighty River of Song" for Royal Albert hol on 12 May 2007, Di BBC Electric proms concert, Once in a "Blue Moon: wey dem sing for Lal Waterson", for di Cecil sharp hause wey dey London on 25 October 2007, an a Tribute to Bent, wok wey Dem uze sing abaut Albert Lancaster Lloyd, for Cecil sharp haus on November 15 2008, Di Watersons pafom for plenti festival an concert insaid England an Ireland.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

One of im wok Norma Watson, na John Cheley produs am an na Hannibal rekods rilis am in 1996, (dem menshion am for di Mercury Music Prize), shi du am wit im daugta Eliza, hosband Martin Carthy an oda memba wey dey "The Watersons", e stil get Danny Thompson (pentangle), Richard Thompson (Fairport Convention) an Roger Swallow (di Albion Band). In 1999 dem du folo-up for The Very Thought of You wey Hannibal rekods rilis an Richard Thompson, Danny Thompson, Eliza Carthy an hosband Eliza Carthy dey insaid.

In 2001, shi rilis fest album wey dey tok abaut kolsho,Bright Shiny Morning, on Topic Records. Shi dey insaid som oda pipul rekodins, one of dem wey pipul sabi wel na The Transport wit Peter Bellamy's. In 2018 Waterson sho as guest wit im broda Mike on Scottish singa James Yorkston's album When The Haar Rolls In, dem sing dia sista Lal's song, Midnight Feast.

In 2009 for one Topic Records 70-Anniversary Three Score and Ten dem nem three Watersons album and one Waterson: Carthy album as Classic albums. Dem bi Frost and Fire For Pence and Spicey Aly an Waterson:Carthy. Di track wey Norma parfom on na ==Hal an Tow==( track 11 on di CD), Three Score and Ten (track 17), We Poor Labouring Man wit Waterson:Carthy (track 21 on di sixth CD), and Blue Murder, "No one stands Alone(track 22 of di seventh CD).

In 2010 Waterson du album wit im daugta Eliza wey dem kol Gift. Pesin wey dey wok for BBC Laura Barton rait sey hol di Waterson Famili na talent fom; Norma Waterson an Eliza Carthy, dia mama an pikin wey mek singin abaut kolsho popula for British, na wen e dey tok abaut di final song, "Shalow Brown", shi stil notis sey hol di famili memba sopot di song, Eliza papa Martin Carthy pley guitar an anoda famili memba Oliver Knight on electric guitar, vocals an cello.

In 2016 Waterson kolet Lifetime Achievement award fom BBC Radio2 folk Awards wit Joan Armatrading.

Dem sabi Waterson as head of di famili shi kontinue to sing well wen shi dey 70s, Plenti pipul tok sey shi dey wok wel wel, sey na persin wey no gree stop to dey go sho an du rekods. Waterson final album, wey shi rilis in 2018, wey bi di sekond wit Eliza. Na Waterson sing lead on Toms Waits song "Strange Weather" an on version of Nick Lowe's The Beast in Me.

Parsonal life an hau shi tek kpai[chenj-am | chenj-am for orijin]

Waterson mari Martin Carthy in 1972. Dem bon dia Pikin Eliza in 1975.

Shi kolet MBA(Member of the Order of British Empire) in di Queen's 2003 New Year's Honours, for hau shi tek wok insaid her music.

Waterson kpai on 30 January 2022, wen shi bi 82. Shi don dey suffer fom Pneumonia.

Som of im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Frost and Fire (1965)

The Watersons (1966)

A Yorkshire Garland (1966)

For Pence and Spicy Ale (1975)

A True Hearted Girl (1977) (Lal & Norma Waterson with Maria Waterson)

Sound, Sound Your Instruments of Joy (1977)

Green Fields (1981)

Early Days (1994)

Mighty River of Song (2004)

A Yorkshire Christmas (Witchwood Collection, 2005)

With Waterson:Carthy

Waterson:Carthy § Discography (all on Topic Records)

Waterson:Carthy (1994)

Common Tongue (1996)

Broken Ground (1999)

A Dark Light (2002)

Fishes And Fine Yellow Sand (2004)

Holy Heathens and the Old Green Man (2006)

Solo discography

Norma Waterson (Hannibal Records, 1996)

The Very Thought of You (Hannibal Records, 1999)

Bright Shiny Morning (Topic Records, 2001)

Gift (Topic Records, 2010) with Eliza Carthy

Anchor (Topic Records, 2018) with Eliza Carthy and the Gift Band.