Nordic Africa Institute

From Wikipedia

Nordic Africa Institute (NAI) (Swedish: Nordiska Afrikainstitutet) na di place where dem dey do plenty plenty work wey concern Africa mata. All the things wey dem dey write no be for only people wey dey inside academic world, even people wey dey work inside government in Africa and Nordic area fit learn about Africa mata from NAI writings and advise. Na 1962 wey di government of Sweden, Finland, Norway, Denmark, and Iceland join hand and money together start NAI. Denmark (in 2013) and Norway (in 2015) come later commot their hand and money from NAI mata.

NAI na government agency for Sweden, and dem boss na di Swedish Ministry of Foreign Affairs.[1] NAI office dey for Uppsala, Sweden. [ NAI get oga patapata wey dem dey call Director. NAI come get another body wey dem dey call Programme and Research Council wey dey advise the Director. NAI na part of AEGIS, di body wey brin together places where dem dey study Africa mata for Europe.[2]

External links[chenj-am | chenj-am for orijin]

Referens[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. https://www.regeringen.se/myndigheter-med-flera/nordiska-afrikainstitutet/
  2. https://www.aegis-eu.org/members