Norah Montgomerie
Norah Montgomerie or Norah Mary Shargool (dem bon April 6, 1909 an e kpai on February 19, 1998) na Bristish pesin wey dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way. E na raita an e sabi put piksho for buk so dat pipul go ondastand di ridin.
How e tek stat life an go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for West Dulwich, London dey bon Norah Shargool. Norah papa nem na John Shargool an e mama nem na Letitia Alexander Shirley Shargool ( Norah mama nem na Sawyer bifor e mari). E papa na hakantant an e mama bi telor wey dey mek klot. Norah go bordin skul wey de Folkestone an e still gi akt skul wey de London.
Norah tok inside Niuz-pepa sey e sabi sing, tok tori bikos e len dem from e gra-mama an sey e no fit foget e gra-mama advais wey bi: "No give smol pikin pap, give dem somtin wey dey fit chop for mouth". Norah dey mek suo sey e dey yuz dis advais for all e wok.
How e tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Norah Montgomerie stey forDundee wia e wok for Skotish poblishin kompini DC Thomson. E still wok in London as pesin wey dey draw pikshor for magasin for pipul to ondastand di magasin as dem dey rid am. For Norah wok, e dey sopot Scot langwej, dia tradishonal tori an dia muzik. Norah join bodi wit e hosband to rekod an kip Skotish tradishonal muzik, dia smol smol pikin song-dem. E still hep rait an draw for meni tradishonal song an for smol pikin-dem song. Some of di song wey e hep rait or draw inside na:
- Sandy Candy and other Scottish Nursery Rhymes (1948)
- The Well at the World's End (1956)
- The Hogarth book of Scottish nursery rhymes (1964)
- From Time to Time: Selected Poems (1985)
Norah stil rait an draw pikshor for e own buk like:
- Merry Little Fox and Other Animal Tales (1959)
- Twenty-five Fables (1962)
" To Read and to Tell (1964)
- This Little Pig Went to Market: Play rhymes for infants and young children (1966, with illustrator Margery Gill)
- One, Two, Three: A Little Book of Counting Rhymes (1967).
In 2009, Norah gra-son, Julian Brooks gada all di wok wey Norah don yuz e hand rait an e mek one buk from am. Di nem of di buk na: The Fantastical Feats of Finn MacCoul.
E pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Norah Shargool mari William Montgomerie in 1934. William Montgomerie na Skotish raita an pesin wey dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way. Di marej produs two pikin, Dian an Ian. Norah hosband kpai in 1994. Norah sef kpai in 1998. E kpai in Edinburgh wen e bi 78 years old.