Nkiru Sylvanus

From Wikipedia

Nkiru Sylvanus (dem bon am for April 21,1985) na Naijá aktres an Politishian.Shi don akt ova two hundred fims an win awod for Aktres wey Sabi akt pass inside a year for di Africa Magic Viewer Award an best Aktres in a linding rol at Africa Movie Academy Awards.


Born :Nkiru Sylvanus 21 April 1985 (age 36) Abia State, Nigeria Alma mater:Enugu State University of Science and Technology Occupation:Actresspolitician Years active:2001-Present

How Shi Tek Stat Life An Skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Osisioma, Aba, a Citi inside Abia Stet in Naijá.Shi go Ohabiam primari an sekondari skul na for dat skul shi kolect ha fest skul livin Sirtifikate an West Africa senior skul Sirtifikate. Shi Kom Leta go Enugu State uzniversity of Science and teczhnologygo kolet BSc digri Sirtifikate for Mass Kommunikashon.

How Shi Tek Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Inside one Tori for Punch Niuz Pepa, Sylavanus stat to dey akt fims wen e bi 17 years old an di year na 1999. Shi don dey inside fim whey pass ova 70 for Nollywood. Guardian Pepa chuz Sylavanus as di Selebiti wey go sho for dia Pepa in 2017 an 2018.

How Shi Tek Join Politik[chenj-am | chenj-am for orijin]

Foma gofnor of Imo Stet, Rochas Okorocha chuz Slyvanus as one of e kabinet in 2011.E wok na Speshal Asista on mata wey Lagos Stet dey. Sylvanus leta chenj to Speshal Asista for poblik affair.

2012 Kidnap an Riliss[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Sylvanus stil bi speshal assistant to foma gofnor of Imo stet Rochas Okorochas for public Affairs, krimina pipul-dem kidnap am on December 15, 2012 for 2:30pm. For di tori inside Vanguard publikashon, di kidnappa dem want 100 million naira bifor dey go riliss Sylavanus. 100 million Naira na 640000 for Dollar.We leta hear fom one report for Niuz sey kidnappa don riliss Sylavanus.Dey no tok di if dey giv di kidnappa money or dey no giv dem.

Pasona Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2014, Sylvanus Mari Stanley Duru. As of 2019 dey don share garri o! (mean sey dem don separate O!!)

Awod[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Best Aktres of di Year at di Africa Magic Viewers Choice Awards
  • Best Aktress in a Lidin Rol at di Africa Movie Academy Awards

Fim Wey Shi Don Du[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Final Tussle (2008)
  • Life Bullets (2007)
  • Fine Things (2007)
  • No More Love (2007)
  • Secret Pain (2007)
  • She Is My Sister (2007)
  • The Last Supper (2007)
  • Treasures Of Fortune (2007)
  • Alice My First Lady (2006)
  • Buried Emotion (2006)
  • Divided Attention (2006)
  • Pastor’s Blood (2006)
  • Serious Issue (2006)
  • Sweetest Goodbye (2006)
  • What A Mother (2005)
  • Dangerous Mind (2004)
  • Hope Of Glory (2004)
  • King Of The Jungle (2004)
  • My Blood (2004)
  • Queen (2004)
  • The Staff Of Odo (2004)
  • Unconditional Love (2003)
  • Egg Of Life (2003)
  • Green Snake (2003)
  • Six Problems (2003)
  • Holy Violence (2003)
  • Last Weekend (2003)
  • Onunaeyi: Seeds Of Bondage (2003)
  • The Only Hope (2003)
  • A Cry For Help (2002)
  • Love In Bondage (2002)
  • Miracle (2002)
  • Pretender (2002)
  • Unknown Mission (2002)
  • Never Come Back (2002)
  • Terrible Sin (2001)