Nicolas Jackson

From Wikipedia
Nicolas Jackson
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromSenegal Chenj-am
Country for sportSenegal Chenj-am
Nem for lokal langwejNicolas Jackson Chenj-am
Fest nemNicolas Chenj-am
Famili nemJackson Chenj-am
Wen dem bon am20 June 2001 Chenj-am
Ples wey dem bon amSenegal Chenj-am
Fest langwejFrench Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokFrench Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am

Nicolas Jackson (dey bon am 20 June 2001) na futbola wey dem bon for Gambia but e dey play for Senegal nashonal Tim. Jackson dey play front posishon for La Liga klub Villarreal.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Banjul wey de Senegal e papa papa-dem kom from. Na for Ziguinchor, Senegal e gro up. Jackson don plai for di lokal side ASC Tilene bifo joinin Casa Sports. Jackson de di Casa Sports tim wey plai 2018-19 Senegal Premier Ligi. Wen Casa Sports plai 1-1 with AS Pikine on 16 November 2018, na Jackson dey pik as Man of di match.

  • Villareal

For September 2019, Jackson sahin to be Villarreal FC playa. E dey plai for dia Juvenil A tim.

  • Mirandés

On 5 October 2020, Villarreal FC boro CD Mirandés wey de Segunda División Jackson mek e plai for dem in di 2020-21 Sisin. 13 days leta, e plai di sekod half of di 0-0 match against RCD Mallorca wen e enta for Antonio Caballero. Na for 28 November 2020 Jackson net q goal in di 1-1 game with CD Castellón. Na di onli goal wey e score bi day as e Tim finish for 10 posishon.

Wen Jackson riton bak to Villarreal FC, e plai for di tim B in Primera Divisíon RFEF. Jackson net 7 goal as e tim promot to di sekod division. On 3 October 2021, e plai e fest La Liga game wen e enta for Arnaut Danjuma in di game wey Villarreal FC tek win Real Betis 2-1.

Jackson net e fest La Liga goal on 13 August 2022 wen e score di fest goal in di 3-0 win against Real Valladolid. 13 days leta, Jackson an Alex Baena enta as pamanet playa for sinior Tim of Villarreal FC.

Villarreal FC redi to sel Jackson for 22.5 million Euro to AFC Bournemouth in January 2023, but di injuries wey Jackson get mek am no fit pass di medikal test wey dem do for am for Bournemouth.

How e tek plai futbol for e kontri[chenj-am | chenj-am for orijin]

Senegal kol Jackson on November 2018 to kom plai for dem. E join di tim wey plai for Senegal for U-20 Levu. For September 2022, Senegal tim manija Aliou Cissé kol Jackson to kom plai two frend-li game for Senegal. Wen di nel of 26 playa wen wan go 2022 FIFA World Cup kom out on 11 November 2022, Jackson nem de. E enta for Krépin Diatta for di game wey Netherland tek beat Senegal 2-0.

Club[chenj-am | chenj-am for orijin]

Templet:Updated

Appearances and goals by club, season and competition
Club Season League Copa del Rey Continental Other Total
Division Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals
Mirandés 2020–21 Segunda División 16 1 1 0 17 1
Villarreal B 2021–22 Primera División RFEF 25 5 2Templet:Efn 2 27 7
Villarreal 2021–22 La Liga 9 0 1 0 0 0 10 0
2022–23 La Liga 26 12 2 0 10Templet:Efn 1 38 13
Total 35 12 3 0 10 1 48 13
Career total 76 18 4 0 10 1 2 2 92 21

Templet:Notelist