Jump to content

Ngozi Nwosu

From Wikipedia
Ngozi Nwosu (2017)

Ngozi Nwosu (dey bon am 1 August 1963) na Naija aktres an fim produsa. Na Yoruba fim-dem Nwosu yuz stat to dey akt fim bifor e kom akt insaid Living in Bondage. Living in Bondage na one Igbo langwej fim.

Hau e tek stat laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ngozi Nwosu on 1 August 1963 an e kom fom Arochukwu wey bi one vilej for Abia Stet. Na insaid Legos Nwosu gro up. Nwosu papa na Biafra Solja an e kpai dorin di Naija Sivu War. Nwosu sabi spik Igbo, Yoruba, an Inglish langwej wel wel

Hau e tek go skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Nwosu du e pamari Skul for St. Anglican skul wey de Idi Oro. E kom go Maryland Comprehensive Hi- skul wey de Ikeja, Lagos. Na for East Rosary Hi-skul e tek finish im sekondri edukeshon. E kolet aktin trenin fom Revuren Fabian Oko as na for Royal Tihata Akt Klub Skul dis trenin hapun.

Hau e tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Web Nwosu stil dey skul, e stil dey go akt fim an plenti of di fim na for yoruba langwej. Na Nwosu du di pat of "Madam V boot" for di TV program, Ripples. Na Nwosu bi di fest Naija aktres wey kiss insaid Naija fim. Dis one hapun insaid di fim Living in Bondage wey e an Kenneth Okonkwo dey du lovi lovi insaid di fim. Pipul no Nwosu wel wel as di pesin wey akt as Peace insaid di TV sho Fuji House of Commotion. Na Amaka Igwe produs dis TV sho. For Fuji House of Commotion, na im bi di sekond waif of Shif T.A Fuji wey di Shif laik wel wel. For 2018, na Nwosu vois dey tok as Ene insaid di babi fim wey dey kol Sade. Nwosu tok sey evri fit ondastand di fim bikos di fim fonni. Na im stil produs Evil Passion, Stainless, an di redio sho Onga. Web Nwosu dey tok abaut mata wey konsain luv bitwin man an wumen for di fim indostrie, e tok sey e dey norma if produsa wey bi man for mit aktres sey e laik am bot sey e no add to di aktres respet if na dem go dey mit man for dat kain tins. Nwosu stil tok sey evri aktres fit chuz to sey yes or no to tins wey e laik or e no laik. Nwosu don elp akt insaid for muzik vidio for muzishan laik Chidinma Ekile, Fair Prince, an Davido. E stil folo de insaid di vidio

E pasonal laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Nwosu kansu im weddin two daiz bifor di serimoni bikos e tok sey im hosband blo am wel wel wen e stil dey kari belle. For 2012, Nwosu sik wel wel an dis siknes afet im wok as aktres. Doktor leta konfam sey na kidni disis e get. Nwosu go Oyinbo kontri for tritmet as govamet an som organaseshon elp am. Nwosu tok sey e no go du firee wok for im stet, Enugu Stet, bikos e tok sey di stet no elp am wen e nid dia elp.

Fim-dem wey e don akt

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Nwosu akt insaid Light in the Dark (2029). Insaid di fim, Joke Silvia, Rita Dominic, Angel Unigwe sef join akt insaid am. Nwosu olso akt in The Silent Baron, an Crazy Grannies.

E pasonal laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Nwosu kansu im weddin two daiz bifor di serimoni bikos e tok sey im hosband blo am wel wel wen e stil dey kari belle. For 2012, Nwosu sik wel wel an dis siknes afet im wok as aktres. Doktor leta konfam sey na kidni disis e get. Nwosu go Oyinbo kontri for tritmet as govamet an som organaseshon elp am. Nwosu tok sey e no go du firee wok for im stet, Enugu Stet, bikos e tok sey di stet no elp am wen e nid dia elp.

Fim-dem wey e don akt

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Nwosu akt insaid Light in the Dark (2029). Insaid di fim, Joke Silvia, Rita Dominic, Angel Unigwe sef join akt insaid am. Nwosu olso akt in The Silent Baron, an Crazy Grannies. Oda fim-dem wey Nwosu de na:

  • Living in Bondage(1992)
  • Circle Of Doom(1993)
  • Fake Doctor(2002)
  • A Cry For Help(2002)
  • No Shaking(2003)
  • Dry Fish(2003)
  • Greatest Weapon(2006)
  • Before Ordination(2006)
  • Tanbolo(2006)
  • Old Cargo(2007)
  • Next Door Neighbour(2007)
  • Throne Of Tears(2008)
  • My Darling Princess (2008)
  • Holding Hope(2010)
  • Kidnap(2012)
  • Stigma(2013)
  • Beyond Disability(2014)
  • Skinny Girl in Transit(2015)
  • The Inn(2016)
  • Isoken(2017)
  • The InLaws(2017)
  • My Wife & I (2017)
  • The Other Wife(2018)
  • Sade(2019)
  • Knock out (2019)
  • Dead Rite(2019)
  • Light in the Dark(2019)
  • Sweet Face(2020)
  • Dream Job(2021)
  • Crazy Grannies (2021) as Cheta
  • Before Valentine's(2022)
  • The Pattern (2022)
  • Silent Baron (2022)
  • Ije Awele (2022) as Iya Olumide
  • The Smart Money Woman (2024)