Ngozi Ezeonu

From Wikipedia

Ngozi Ezeonu (dem bon as Ngozi lkpelue on May 23,1965) Naijá aktres an foma jonalist wey dey popula for fim bikos e like to du like mama for fim.Ezeonu pat for di 2012 fim Adesuwa mek am bi pat of Aktres wey dey list for di 8th Africa Movie Academy Awards for di katigori Best Supporting Actress .

Tori Abaut E Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ezeonu kom from Ogbunike wey dey Owerri. Im papa na Dennis Ikpelue an e mama na Ezenwanyi Ikpelue an shi get six sista.Bifor shi kom dey popula for aktin shi stodi jonalism for di Nigerian institute of journalism an wok fo Radio Lagos an Eko FM

How E Tek Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ezeonu nowadaz dey akt mama an gramama rol, bot wen e fest stat akt na yong ladi rol e dey du. Pipul sabi Ezeonu as mama wey no dey tek nonsense for e Pikin-dem for fim.For 1993, Zeb Ejiro wey bi koret Dareto giv Ezeonu suportin rol as Nkechi di fof di Igbo blockbusta Nneka The pretty serpent. Afta, dem giv ha anoda rol for 1994 for di fim Glamour Girls as Thelma wey shi bi high society mistress.

Fims Wey Shi Akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

1994 – 2007

  • Ada Vigilante
  • End of Ada Vigilante
  • Evil Project
  • Senseless
  • Best Honeymoon
  • Enslaved
  • Definition of Love
  • End of a Princess
  • Glamour Girls – 1994
  • Nneka The Pretty Serpent – 1994
  • I Swear – 2004
  • Occultic Kingdom – 2005
  • Abuja Top Ladies – 2006
  • The Love Doctor – 2007
  • Royal Grandmother 1 and 2 – 2007

2008 – 2016

  • Tears in My Eyes – 2008
  • Throne of Tears 1, 2 and 3 – 2008
  • My Darling Princess – 2008
  • Tears of a Prince – 2009
  • Sister Mary and Ossy – 2009
  • Stone Face – 2009
  • Secret Shadows 1 and 2 – 2010
  • Wise In-Laws – 2010
  • A Private Storm – 2010
  • Adesuwa – 2012
  • Shattered Mirror – 2012
  • The Kings and Gods – 2012
  • Broken Engagement – 2013
  • Palace War – 2014
  • Tears of a Virgin – 2014
  • Luscious Lucy – 2016
  • Tears of the Innocent – 2016
  • Zenith of Sacrifice – 2016
  • Heritage – 2016

2017 – 2019

  • Tears and Glory – 2017
  • Child of Pain – 2017
  • Tell Me Why – 2017
  • Pretty Little Thing – 2017
  • Family Secret – 2017
  • A Better Family – 2018
  • Lion Heart – 2018
  • Confessor – 2018
  • Different Worlds – 2019
  • Seed of Destruction – 2019
  • Dusted Crown – 2019
  • Crazy Princess – 2019
  • On All Sides – 2019
  • Run Away From Love – 2019
  • If Trouble Comes – 2019
  • Making a King – 2019

2020 – 2021

  • Nkasi my flesh and blood
  • Prince Decision
Caption text
Year Awod Katigori Wok ResoIt.
2012 Africa movie Academy Awards Best supporting Aktress Adesuwa win [6]