National Arts Theatre

From Wikipedia
National Arts Theatre
theatre building, tourist attraction, monument
Inception1976 Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityLagos, Lagos State Chenj-am
Coordinate location6°28′35″N 3°22′10″E Chenj-am
Based onPalace of Culture and Sports Chenj-am
Map

National Arts Theatre, Igamu, lagos. Di Nashional Tiata, Naijá na di major ples for pipul wey wan sing, dans an akt fim for stage. Di Tiata dey for Iganmu, Surulere, Legos. Na for 1976 deyb komplet am so dat dey go yup am for di Festival of Arts and Culture (FESTAC) wey happun for 1977.Anoda nem for Nashional Tiata na Nigeria Home of Entertainment. Di pipul wey dey arenj tins dia wan protet, kip an promot Naijá art an Kulture. As na partially commercial and Federal Government project, Dem dey do many things to dey creative and competitive fo di market.

How them Design am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Construction of The National Theatre start during the military regime of General Yakubu Gowon and complete during the military regime of Olusegun Obasanjo. For the year 2021, different people done manage this Edifice, some of then na, Jimmy Folorunso Atte (1991 – August 1999), Prof Babafemi A. Osofisan (2000 – 2004), Dr. Ahmed Parker Yerima (2006 – Aug 2009), Kabir Yusuf (2009 – 2016), George Ufot, (Late) Dr. (Mrs.) Stella Oyedepo, Professor Sunday Enessi Ododo, fsonta, FNAL. The way them design the outside of the structure look like a military hat. The original capacity na 5,000-seater Main Hall with stage wey them fit collapse, and two capacity cinema hall, all this hall dey equip with the thing wey fit make translation of 8 language at thesame time possible, among others. Na Bulgarian construction company (Techno Exporstroy) build the National Arts.

Disagreement wey happen[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2005, President Olusegun Obasanjo announce sey them wan privatize the National Theatre. This on cause diagreement amongst Nigerian entertainers and playwrights like Wole Soyinka On 30 December 2014, report come sey them done sell National Theatre to one Dubai-based conglomerate for the sum of $40million, and them go convert the building to duty-free shopping mall.

Appearance for media[chenj-am | chenj-am for orijin]

• Filming for the "Keys to the Kingdom" video for Beyonce's visual album Black is King happen for National Arts Theatre, Lagos. • Burna Boy perform a medley of his hits "Level Up", "Onyeka" and "Ye" for front of and inside the building, during the Premiere ceremony of the 63rd Grammy Awards, for March 2, 2021. Later that week, him album Twice as Tall win the Grammy Award for Best Global Music Album. . Alhaji Sule Katagum na co-owner and chairman. It resemble the Palace of Culture and Sports for Varna, Bulgaria (complete for 1968); the National Theatre Lagos, Nigeria na im big pass.