Jump to content

Nancy Isime

From Wikipedia
Nancy_Isime_at_AMVCA_2020_26

Nancy Isime (dem bon am December 17, 1991) na Naijá aktres,model an midia pasonaliti.

Tori of e laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Edo Stet dey tek bon Nancy Isime.E go University of Lagos go du one kouse for soshia wok for 2 years. Isime mama dai wen e dey 5 years old an na im papa tren am.Isime gro up for Legos an na Legos e tek du e pamari an junior Sekondiri edukashon.Isime kom go Benin go du e sinior sekondiri edukashon.E leta du six month bazik kouse for Uniiversity of Port Harcourt an Diploma for soshial wok for ' University of Lagos.

How e tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2009, Nancy Isime win di miss valentine intanashonal beauti pageant an e kari sekod for di miss telikom Naijá beauti kontest.Isime du modelin for kompani dem laik "house of Marie" " Ade BaKere" "Adeboye Jones" "Zizi Cardow" Shakara Couture " "Konga Online" an odas. Isime tok somtin abaut di modelin for Naijá, e sey model na somtin wey pesin go tri plenti taim ontil pesin go get big break onlaik for westa kontri dem wey bi sey wen pesin get big break e don mek am for laif bi dat. Bot for Naijá, ivun wen pesin don get big break pesin stil nid to wok had to kip am so pesin nid to dey kom for mor.ns Nancy bi di tok tok for di voice of Naijá.

Isime stat ha karia as aktres for di TV series Echoes for 2011

Telivishon an Ivent Host

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Isime na telivishon prisenta, pipul no am for di amebo sho The squeeze Tekinologi sho What's Hot an backstage segment of MTN project fame season 7. For 2016, Isime ripias Toke makinwa as di prisenta of di popula sho wey pipul sabi luk for Hptv.Isime bi pat of di prisenta for di 2019 edishon of di Headies awad wit Reminisce.Na Isime bi di prisenta for The Voice Naijá for 2021.

Fims wet shi don du

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • Hex (2015)
  • Tales of Eve (2015)
  • On the Real (2016)
  • A Trip to Jamaica (2016)
  • Hire a Man (2017)
  • Finding C.H.R.I.S (2017)
  • The Surrogate (2017)
  • Treachery (2017)
  • Kanyamata
  • Tempted
  • Guilty
  • Kylie's Quest
  • A Better Family (2018)
  • Club (2018)
  • Johnny Just Come (2018)
  • Liars and Pretenders (2018)
  • My Name is Ivy (2018)
  • Sideways (2018)
  • Disguise (2018)
  • Merry Men: The Real Yoruba Demons (2018)
  • Don't get mad get even (2019)
  • Hire a Woman (2019)
  • Adaife (2019)
  • The Millions (2019)
  • Beauty in the Broken (2019)
  • Another Angle (2019)
  • Merry Men 2 (2019)
  • Levi (2019)
  • Living in Bondage: Breaking Free (2019)
  • Made in Heaven (2019 film) (2019)
  • Kambili: The Whole 30 Yards (2020)
  • Creepy Lives Here (2021)
  • The Razz Guy (2021)
YearAwodKatigoriFimResot ! Ref
2016city people Entertainment AwardsBest Vj of the yearN/Awin
2016Nigeria Broadcasters merits AwardsSexiest on Air personality (Female)HipTvwin
2017The future AwardsBest on Air personality (Visual)N/Awin
2018Best of Nollywood AwardsBest Actress in a lead Role EnglishDisguiseNominated
2018City people movie AwardsMost promising Actress (English)N/Awin
2018City people movie AwardsBest supporting Actress (English)N/Awin
2019Best of Nollywood AwardsBest kiss in a movieJofranwin
2019Best of Nollywood AwardsBest Actress in a lead role EnglishJofranNominated
2021Net HonoursMost popular media personality (Female)N/ANominated
2021Net HonoursMost searched media personalityN/ANominated