Nana Klutse

From Wikipedia
Nana Klutse
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromGana Chenj-am
Wen dem bon am23 May 1981 Chenj-am
Wok wey e dey duclimatologist, researcher Chenj-am
Wu e dey wok forUniversity of Ghana, Ghana Atomic Energy Commission, University of Cape Coast, University of Cape Coast, African Institute for Mathematical Sciences Rwanda Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Cape Town Chenj-am

'Nana Ama Browne Klutse (dey bon am for 23, May 1981) na Ghana leshura an Sayentis wey dey stodi klimet or how weyda kondishon de chenj ova a long piriod of time.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Nyanfeku Ekroful dey tek bon Nana Ana Browne Klutse on 23 May 1981. Klutse go Anomabo Methodish pamari and JHS for e pamari skul. E go Mfantsiman Girl Secondary Skul an leta Yunivasiti of Cape Coast in Ghana. For yunivasiti, Klutse get B.Sc Physics. Dr Klutse du e Ph.D in Climatology for Yunivasiti of Cape Town wey de South Afrika.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dr Klutse stodi how klimet or weyda kondishon dey chenj in West Afrika. E stodi na abaut how di dareshon of breeze dey hafet renin sisin an dry sisin. Dr Klutse bi di sinior leshura at di Dipatmet of Physics in Yunivasiti of Ghana. Bifor bifor, na Dr Klutse bi di oga for one senta kol "Remote Sensing and Climate Center". Kluse bi memba of Klimet Sayens Felo of di African Institute for Mathematical Sciences an e na lid raita wey dey rait inside IPCC Sixth Assessment Report (AR6). Klutse stil dey hep mek meni gel-pikin join bi sayentis in Ghana as e dey sopot sayens edukeshon in di kontri. From 2016 go rish 2018, Klutse wok for "Ghana Space Science and Technology Institute" of di Ghana Hatomik Henagi Kommishon as dia sinior risasha . Bifor dis wok, e don bi visitin leshura at di "West African Science Service Centre on Climate and Adapted Land Use" (WASCAL) in Akure inside Naija.

How e tek put hand inside politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Klutse na memba of di Nashonal Demokratik Congress.