N'Golo Kanté

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
N'Golo Kanté
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromFrance Chenj-am
Country for sportFrance Chenj-am
Nem for lokal langwejN'Golo Kanté Chenj-am
Fest nemN'Golo Chenj-am
Famili nemKanté Chenj-am
Wen dem bon am29 March 1991 Chenj-am
Ples wey dem bon amParis Chenj-am
Fest langwejFrench Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokFrench Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialitymidfielder Chenj-am
Wen e stat wok2012 Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
Sport number7 Chenj-am
Participant inUEFA Euro 2016, 2018 FIFA World Cup, 2018 FIFA World Cup qualification – UEFA Group A Chenj-am
LeagueLigue 2, Championnat National, Ligue 1, Premier League Chenj-am
Awod wey e koletKnight of the Legion of Honour Chenj-am

N'Golo Kanté (Dem bon am for 29 March 1991) na ogbenge French futbola wey dey pley as divensiv midfeilder for premier league klob Chelsea an for France Nashona team. Dem sabi am as bes midfielder for wod, dem sabi am bikos of hau e dey tek kolet bol an hau e dey pas bol wel. E go join Saudi Pro League klob Al-Ittihad on July 1 2023. Kante fest pley for sinior team futbol of Boulogne in 2012, e enta for anoda playa for one Ligue 2 match, an e pley for third division di year wey folo. Afta dat klob e join anoda klob wey dey Ligue 2, Caen on a free transfa, dem finish third wey mek dem kom pley for Ligue 1. E dey wit di klob for anoda one year. In 2015, Kanté join Leicester City for £5.6 million.

Kanté dey insaid Leicester team wey win Premier League championship in 2016. Year wey folo e join Chelsea for £32 million an win di league, na dat one mek am dey insaid playas wey don win league wit difren klob wit Eric Cantonna in 1992 an 1993. Wit Chelsea e don win FA Cup, di UEFA Europa League, di UEFA Champions League, di UEFA Super Cup, an di FIFA World Cup. Onli am, don win Premier League playa of di season, di PFA playas' of the year, di FWA Futbola of the year, di UEFA Men's Midfielder of di year an di Troophées UNFP for Bes French playa abroad two times.

Kante fes pley for im kontri France in 2016 an na dem kari sekond at di 2016 European Championship's. In 2017, na Kanté dem giv French playa if di Year, wey bi fes for playa wey dey premier league in seven years, an twelve month leta e stil dey insaid FIFA Wod Kop winning team.

Im klob wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Boulogne

Dem bon am for Paris to Malian papa an mama. Kanté stat to dey du im wok wen e dey eight years old for JS Suresnes, e dey dia for ten years. Sekond Coach Pierre Ville tok sey plenti big team no wan buy am bikos of im smol bodi an e no dey lik mek onli am dey again. Dem no gree sign am for Clairefontaine Academy. In 2010, Arsene Wenger wey bi Arsenal manager dat time wan sign Kanté. Suresnes' president (wey bi Wenger best frend) kari am go difren klobs. E join Boulogne risarf team, an fes pley for di team insaid beta match on 18 March 2012, Ligue 2 season, dey lus di match 1-2 to Monaco. E enta for Virgile Reset for di las 11 minutes.

For di 2012-13 season, e pley for di third Championnat National, an na onli one game e mis. On 10 August, e skore im fes sinior goal, na di goal bi di onli goal wey enta dat day wey dem win Luzenac at di Stade de la Libération.

Caen

In 2013 e join Ligue 2 Caen an pley hol 38 match for im fes season, na dem kari third for ligue 2 ,wey mek dem kom Ligue 1. Insaid im sekond match e skore goal wey insaid 2-1 game wit Laval; e still skore anoda goal On April 11 2014, insaid 3-2 match wit Istres.

Season wey folo, Kante pley 37 games as Caen dey Ligue 1, e no pley one match bikos of red kard wey e Kolet web dey pley Rennes on 30 August. Bifor dat one e don skore dia 3-0 win wit Elvian. Na e Kolet bol pas for pesin leg insaid Europe for dat season.

Leicester City

Steve Walsh hep Leicester fain Kanté, an na im stil dem sain Rihad Mahrez an Jamie Vardy. On 3 August 2015, e join Leicester onda four year kontrat, for moni wey dem no let pipu no, bit som tok sey e rich £8 million (£5.6 million). E fed pley for dem afta five days web e enta for Jamie Vardy insaid match wey dem win 4-2 wit Sunderland. On 7 November, e skore im fes premier League goal web dem pley wit Watford, dey win di match 2-1 for dia aouse.

Plenti pipu lik hau e tek pley for Leicester, Som tok sey na bikos e pley wel wel mek Leicester wn 2015-2016 Premier League. In April e dey insaid four playas wey dem chuz fom Leicester wey mek PFA Team of di year.

Chealsea

2016-2018: League and FA Kop Finals

On 16 July 2016, Kanté sign five years kontrat wit Chealsea wey pay £2million for am. Na Arsenal wan sign am bifor bit dey leta komot hand bikos of sey Di moni tu plenti. Na nomba 7 shirt dem giv Kanté, wey don dey ground sins Remires don komot for Chealsea.

On 15 August 2016, Kanté pley im fest match web dem pley wit West Ham United. Ontop sey e Kolet yello kard, Kanté hep Chelsea win di match 2-1. Afta 3 months wey e go Chelsea, e pley match wit im bifor bifor team Leicester, na im bi Man if di match afta dey win 3-0. On 23 October, e skore im fest goal for Chealsea insaid 4-0 wey dem beat Manchester United.

On 26 December 2016, na Kanté L'Équipe kol as di sixth bes fotbola of 2016. On March 2013, na Kanté bi di man of di match an e stil skore goal in di 51th minutes, insaid FA quarter final match win wit Manchester United for Stamford Bridge. On 20 April, Kanté nem dey insaid di PFA Team of di year for di sekond season. Na Kanté bi di PFA playas' of di year , di FWA futbola of di year, an di Premier League futbola of di season. Na Kanté bi di fes playa wey win League for England one year an di year wey folo wit two difren klobs, afta Eric Cantona in 1993. Kanté nem dey insaid playas wey go win Ballon d'Or in October 2017. E win prize as FA kop win a, wen e pley for 90 minutes for final wit Manchester United on May 19 2018, na dem win 1-0 for di match. BBC Sport giv Kanté man of di match.

2018-22: European an Champion wod

Kanté sign for 5 years for Chealsea on 23 November 2018, an na im dey Kolet moni pas for di klub. Kanté skore Chealsea fest goal insaid dia 2-1 EFL Kop win wit Tottenham Hotspur, di match finish for 2-2 wey mek dia two pley penalty. Kanté skore im 300th goal for klubs web dem pley wit Burnley 2-2 on 22 April.

Kanté no stat match wen di 2019 premier League stat bikos of e get wund. E no stil pley for Champions League match wey dem pley wit Valencia. Na onli Kanté skore for Chealsea wen dem pley Liverpool 2-1 for Stamford Bridge on 22 September 2019. Di fes goal wey e skore for Premier League dey insaid goal wey dem wan giv best goal of di month. Kanté skore for Chealsea wen dem pley Manchester City, na 2-1 Manchester City beat dem on 23 November.

For May 2020, wen COVID 19 dey, Kanté dey du pratis for aouse afta Chelsea don dey du pratis bak. Di klub no fait am dem sopot wetin e du. Kanté pley wel wel web dey stat League wit Brighton & Hove Albion match, Chealsea win di match 3-1 on 14 September 2020.

E sta for Chealsea rich 200 wen dem pley Champions League wit Atletico Madrid. Na dem win di match 1-0 for round of 16. Plenti pipu lik hau e pley wel wel wen dey pley Atletico Madrid an Real Madrid, web dem dey trai enta final. Na Kanté bi man of di match as e win im fest UEFA Champions League web dey beat Manchester United 1-0 in di 2021 UEFA Champions League final for Porto.

For September 2021, Kanté go du test an dem tel am sey e get COVID-19, wey mek an dey far from pipu for ten days. On 8 October, Kanté nem dey insaid 30 playas wey dem kol dia nem wey fit win Ballon'd'Or. On 13 February 2022, e hep Chealsea win dia fest Wod klub kop wen dey win Palmeres 2-1.

Hau e tek wok for im kontri[chenj-am | chenj-am for orijin]

Papa an mama wey bon am na fom Mali, wey mek Mali kol am to kom pley for dem insaid 2015 Afrika kop of Nations. Kanté no gree for dem bikos e tok sey e wan fas Ligue 1. Mali stil ask am kom pley for dem in January 2016, e tok sey e neva no wia e go pley weda na France or Mali.

On 17 March 2016, Kanté nem dey for insaid playas wey go pley for France sinior team wey go pley Netherlands an Russia insaid pley pley match. E pley insaid match for dem afta 8 days, wen e enta for Lussana Diarra for half time when dey win Amsterdam Arena 3-2. On im birthday, e skore for im kontri insaid di match wey dem pley wit Russia for Stade de France; anoda birthday pesin for di sem march 29, Damitri Payet tu skore.

On June 10 2016, Kanté pley im fes competishion match for France wen e stat di fes match in Euro 2016 dem pley wit Romania. E pley di hol match for France. On 17 May 2018, e dey insaid 23 French playas wey dem kol for 2018 FIFA Wod Kop. E pley hol di 7 match for France. Na im bi man of di match insaid di match dem pley wit Denmark on 26 June, di match finish 0-0, an on 15 July, Kanté pley insaid di final match wen dem pley Croatia, na France win di match 4-2.

In May 2021, France kol Kanté to kom pley for dem insaid UEFA Euro 2020. Kanté mis 2022 Wod Kop bikos e get wund.

Im pasona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kanté na Muslim. Na Paris dem bon am to papa an mama wey kom fom Mali in 1980. E gro for one smol plez in Rueil-Malmaison, Hauts-de-Seine. Im papa kpai wen e dey 11 years old an I'm sista kpai bifor dem stat 2018 Wod Kop.

Kanté sista dey pley for Suresnes. Ronaldo, Ronaldinho, an Diego's Maradonna na playa wey e lik wen e smol. Wen e dey 21 years old, wen e dey pley for Boulogne, e get diploma in Vocational Accounting.

Som pipu lik to dey kol am "NG". Anoda tin wey e lik to dey du na to dey pley tebble tennis. E lik karaoke songs. Kanté bes fud na thieboudienne bikos na wetin e mama lik to dey du for am wen e smol bi dat.

Hau e tek wok for teble[chenj-am | chenj-am for orijin]

klub

Appearances and goals by club, season and competition
Club Season League National cup League cup Coupe de la Ligue, EFL Cup|Football League Cup/EFL Cup Europe Other Total
Division Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals
US Boulogne|Boulogne 2011–12 Ligue 2 1 0 0 0 0 0 1 0
2012–13 Championnat National 37 3 2 1 0 0 39 4
Total 38 3 2 1 0 0 40 4
Stade Malherbe Caen|Caen 2013–14 Ligue 2 38 2 4 1 1 0 43 3
2014–15 Ligue 1 37 2 1 1 1 0 39 3
Total 75 4 5 2 2 0 82 6
Leicester City 2015–16 Premier League 37 1 1 0 2 0 40 1
Chelsea F.C.|Chelsea 2016–17 Premier League 35 1 5 1 1 0 41 2
2017–18 Chelsea F.C. Premier League 34 1 5 0 2 0 6 0 1 0 48 1
76935|2018| Premier League 36 4 2 0 5 1 10 0 0 0 53 5
2019–20| Premier League 22 3 1 0 0 0 4 0 1 0 28 3
2020–21|76935|2020 Premier League 30 0 4 0 1 0 13 0 48 0
2021–22|76935|2021| Premier League 26 2 3 0 4 0 6 0 3 0 42 2
2022–23 Premier League 7 0 0 0 0 0 2 0 9 0
Total 190 11 20 1 13 1 41 0 5 0 269 13
Career total 340 19 28 4 17 1 41 0 5 0 431 24

Kontri

As of match wey e pley 3 June 2022

Times wey e don sho an goals e get for kontri

Caption text
Kontri Year Apps Goals
France 2016 13 1
France 2017 7 0
France 2018 16 0
France 2019 3 0
France 2020 5 1
France 2021 7 0
France 2022 2 0

Honors[chenj-am | chenj-am for orijin]

Leicester City

Premier League :2015-16

Chealsea

Premier League:2016-17 

FA Cup: 2017-18, sekond ples: 2016-17, 2019-20, 2020-21, 2021-22.

UEFA Champions League: 2020-21

UEFA Europa League: 2018-19

UEFA Super Cup : 2021

FIFA World Cup< : 2021

EFL Cup : sekond ples 2018-19, 2021-22

France

FIFA World Cup: 2018

UEFA European Championship sekond: 2016

Individual

PFA Team of the Year: 2015–16 Premier League, 2016–17 Premier League

ESM Team of the Year: 2015–16, 2016–17

Leicester City Players' Player of the Year: 2015–16

L'Équipe Team of the Year: 2016, 2017, 2018

PFA Players' Player of the Year: 2016–17

Premier League Player of the Season: 2016–17

FWA Footballer of the Year: 2016–17

Chelsea Players' Player of the Year: 2016–17

Chelsea Player of the Year: 2017–18

UNFP Best French Player Playing Abroad: 2017, 2018

French Player of the Year: 2017

FIFA FIFPro World11: 2018, 2021

UEFA Team of the Year: 2018

UEFA Europa League Squad of the Season: 2018–19

UEFA Champions League Squad of the Season: 2020–21

UEFA Champions League Midfielder of the Season: 2020–21

Opdas

Knight of the Legion of Honour: 2018

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ngolo Kanté BBC Sport