Jump to content

Mudashiru Obasa

From Wikipedia
Mudashiru Obasa
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am11 November 1972 Chenj-am
Ples wey dem bon amAgege Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, lawyer Chenj-am
Post wey e deyLagos State House of Assembly Chenj-am
Wie e go skulLagos State University Chenj-am
Wie e dey livLagos Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am

Mudashiru Obasa (Dem bon am for November 11, 1972) na Naija lorya, Politishian, an memba of All Progressives Congress (APC). Na Obasa bi di Spika for di Lagos State House of Assembly from June 2015 go rish January 2025.

How e tek stat Life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Agege wey dey Legos stet inside Naija dey bon Mudashiru. E do im pamari skul for St Thomas Acquinas Pry School, for Surulere, Legos bifor e kom go do sekondiri skul for Archbishop Aggey Memorial Secondary school for Mushin, Ilasamaja, Legos. Na dia e kolet im satifiket for di West African School. E kolet im Bachelor digri for law in di University of Lagos State for 2006.

=How e tek put bodi for politis mata

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1999, Mudashiru join bodi kontest for kaselor posishion for Agege lokal govament onda Alliance for Democracy party (AD) and e win. D one mek am fit serve in 1999 go rish 2002. For 2019, E join bodi kontest again for eleshon for e aria an stil win. E kom bi memba for Lagos State house of Assembly. Na Mudashiru bi di fest pesin to dey dat sit for three times, an di fifth term rekod. Di time wey dem dey do EndSARS for e stet, dey rekod for live TV wey e tok sey di LSHA no go fit For di time wey dem dey do EndSARS for im stet, wey be Legos dem rekod am for live TV wey e say di LSHA no go fit konfam di pipu wey dai for polis hand wen dem dey du di one minit silence for di pipul wey dem kil for Lekki an oda pipul for Naija

Im koropshon kes

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2020, one ripot for Sahara kari out one mata sey e do magomago abaut one poblik moni. Bot e no gri wit wetin dem put for e hed. Ripot pipul kom leta sey dat Economic and Financial Crimes Commission kari Obasa to ask am som tins from 8 and 9 Octorber 2020. Fom wetin inside pesin tel di Sahara pipul, dem say Obasa do like pesin wey no wel for di EFCC wen dem dey ask am som kwesions, an dis mek dem stop to ask am oda tins. Dem nid to kari Obasa go dia sick bay bifor dey kom free am. Obasa kom ask for im passport for am to go for tritmet for obodo Oyinbo bifor e go do Umrah wia e mit Bola Tinubu for Saudi Arabia. Obasa dey onda haligeshon by di EFCC for Kes of moni magomago.

Dem komot Obasa as di spika of di House on 13 January 2025. Di mejoriti memba of di Legos Stet House of Hasembli tok sey dem must komot Obasa shap-shap. Di risin na bikos dem sey e dey yuz e posishon eni-how. Na Obasa sekod, Mojisola Meranda dey put for Obasa forma posishon.

Wia We Si Pruf

[chenj-am | chenj-am for orijin]