Mr. Ibu

From Wikipedia
Monalisa_Chinda_an_Mr_Ibu

John Ikechukwu Okafor (Dem bon am on October 17, 1961 - March 2, 2024) wey pipul no as Mr Ibu na Naijá akto, an pesin wey dey mek pipul laff. For Naijá, dey no Okafor wel wel sey e get talent an produsa dey giv am moni wel wel for di fim wey e akt for dem. Wen e dey du fim, Mr Ibu dey du laik pesin wey no get sens, E de mek pipul laff, e dey du like mumu an e stil dey du tins dem wey no ril.

Tori of e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na fom Nkanu West L.G., for Enugu Stet e tek kom. Mr Ibu finish pamari skul for 1974.Wen e papa dai, Mr Ibu go stey wit e broda for Sapele.For Sapele, e du smol smol wok so dat e go fit hep e famili an e go fit go skul. Mr Ibu wok for hedresa, foto ples, an Kompini wey dey du krete. Afta e finish sekondiri skul, Mr Ibu enta Koleg of Edukashion for Yola, bot e no finish di skul bikos of moni. Leta, Mr Ibu kom go Institut of Manegimet an Tekinologi (IMT) wen e don get smol moni.

Fims wey e don du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Mr Ibu don dey ova 200 Nollywood fims.Ezampul of fims wey e dey na:

  • Mr Ibu (2004)
  • Mr Ibu and his Son
  • Coffin Producer
  • Husband Suppliers
  • Mr Ibu in London (2004)
  • International Players
  • Police Recruit (2003)
  • 9 Wives (2005)
  • Ibu in Prison
  • Keziah (2007)

Wia wi Si pruf[chenj-am | chenj-am for orijin]