Moses Simon

From Wikipedia

Moses Daddy-Ajala Simon (Dem bon am for July 12, 1995) na Naijá profeshona fut-bola wey dey pley front posishon for Ligue 1 FC Nantes an di Naijá nashonal tim.

Wok wey im don do for klub[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Simon for Jos, na for di femus GBS Akedemi im Tek stat to pley fut-bol. Na dis sem GBS Akedemi na im produs Ahmed Musa. For May 10 2013, dem anounce sey Simon don sign pre-kontrakshual agriment wit Dutch klub AFC Ajax to join dem for pre-sisin trenin. E fest sho for Ajax for July 13, 2013 for pri-sisin frendli mash egenst De Graafschap, E kom up as substitut for di 64th minit of di mash and skor di ted an last gol of the mash. Di mash end 3–0 for there fevor. E still pley for 17 of July, im pley for di resav tim for Ajax for pri-sisin friendli mash agenst Voorschoten '97, im sko di sekond gol and di mash end 5–0 an na Ajax tim win. On 25 of July 2013, Ajax anounce sey dem no go sign di yong Naijá boi. Afta di anouncement , dem kom stat diskushun wit AS Trenčín; Ajax patna klub for Slovakia, wey di ona na Tschen La Ling wey don pley for Ajax bifor. For 13 of January 2014, Simon sign 3 years kontract for Slovak AS Trenčín.

Im wok for Nashonal Tim[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di fest taim Simon sho for Naijá nashonal tim na wen Daniel Amokachi bi kosh for March 2015 an E pley im fest mash on 25th of di sem mont for intanashonal friendli agenst Uganda, wen E reples Anthony Ujah afta 59 minites for di game. Simon skor im fest gol for Naijá for intanashonal friendli agenst Niger for September 8 2015.