Mona Douglas

From Wikipedia

Mona DouglasMBE,RBV( 18 September 1898-8 October 1987)na one Manx pesin wey dey fight for Kolsho right, folklorist, pesin wey dey rait poem,wey dey rait stori,an wey dey rait Nius. Shi wok wel-wel tek Manx Kolsho get levul an stand gidigba. Na shi get maut pass among di pipul wey rait wok on top Manx for 20th Senturi an na shi strong pass for all fine-fine wok dem for tradishonal Manx folk, muzik an dans. Shi join-bodi tek do plenti big wok dem to tek helep mek Manx Kolsho get levul an stand wel-wel an e still join difren-difren Sosaiti, buk wok dem an yong pipul grup dem. Di one wey get levul pas among di wok wey e don do na Yn Chruinnaght.

Wen E stil bi Smol Pikin[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Constance Mona Douglas(Connie) for 18 September 1898 for 49 Allerton Road, Much Woolton, Lancashire(di niu nem nau na Merseyside) Na Frank Beardman Douglas(1863-1943) an Frances Mona(e papa nem bi Holmes- dem bon am for London, Ontario,Canada)bi e papa an Mama an di two of dem kom from Manx.E papa an Mama komot for Isle of Man go Ingland go find wok bot na bekri wok dem kom dey do for Birkenhead. Bikos shi dey sik, dem Kari am go e mama -papa Haus Ellien"Nell" Quayle an Patrick" Pat" Holmes(dia nem na Thomas for do time wen dem kaunt pipul for 1901)wen shi still bi one mont old pikin. E grandma kom dey tish am meni-meni tins abaut Manx,dis kom mek e know plenti-plenti tins abaut di Manx folklore, di song an dans.Shi stay for Lezayre eria,afta kom stay for Ballaragh nia Lacey wen shi stil bi smol -pikin.Na for dis ples dem train am as shi dey grow. Shi even tok say" I no dey go skul dat time bot I jus dey go Ballaragh eria wit som fama dem an I dey go Lacey inside boat wit fishaman dem an I dey play Eni hau as I like". Muzik plenti for Meni of di tins wey dem tek train am wen shi dey smol. Shi even dey enjoi mizik for Meni evnin inside dia Haus.E papa an Mama dem Sabi to play Muzik; e papa play Volin an flute, an e mama Sabi play Piano an Sabi sing.Even di two of dem bi part of one Choral Sosaiti.Wen shi still bi six yias old, Meni pipul for dia komuniti dey gada evri evnin an dem dey read an tok abaut dia Kolsho an muzik. As shi dey see dis tins, shi dey get nolej abaut Inglish an Amerika.