Moll Anthony

From Wikipedia

Moll Anthony wey pipul sabi wel wel as Mary Lesson ( dey bon am araund 1807 an e kpai in 1878) na Irish gud wuman wey live at Hill of di Grande, but e bi like sey na Red Hill, County Kildare e kom from. Dey nem Moll afta e papa Anthony Dunne. Dey beri Moll in Milltown, County Kildare in 1878. Moll fit yuz leaf or plant tek kia of pipul an hanima wey dey sik. Na three pat Moll dey divadi di medisin wwy e dwy yuz tek kia of pipul. Wen di sik pesin fest kom, e go fest give am two poshon of di medisine bottu an di rimeni medisine e go give di sik pesin wey e kom bak. Di moni wey di pesin go pay na 60 cent. Hakordin to one websait: " Law de how pesin go tek yuz, tek, kari di medisine. If pesin no folo di law, di medisine no go wok. Pesin no go try yuz di medisine again if e no wok di fest time wey di pesin yuz am. Di medisine get pawa so tey evil spirit no go wan mek pesin Kari di medisine go house an di evil spirit go dey distop di pesin mek e no yuz am. Even wen di pesin don yuz di third an final medisine wey dey di bottu, some pawaful pawa go wan du mek e no wok. If di pesin yuz di medisine di way dey sey mek e yuz am, di medisine dey wok wel.

E tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Moll Anthony get supanashoral pawa to trit sikness both for hanima an pipul. Some pipul tok sey e get di pawa from spirit. E fit no gri to hep a pesin wey sik sometimes, if Moll tink sey e go beta mek di pesin just kpai or if na di pesin sekod time to kom mit am for di sem risin. Bifor pesin go tell Moll wetin dey du am, Moll go don too di pesin nem an wetin bring am kom .