Moji Olaiya

From Wikipedia

Moji Olaiya (27 February 1975 – 17 May 2017) na Naijá aktress.

Ha karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Moji bi di daughter of hilaif musishian Victor Olaiya, Moji Olaiya stat to dey akt for Wale Adenuga's production Super Story. Shi don akt inside meni Nollywood fim wey bi Yoruba and Inglish.Pipu no Olaiya wel wel for di fim wey shi dey. Som of di fims na: No Pains No Gains, wey shi akt as Ireti, Sade Blade (2005), Nkan adun (2008) an Omo iya meta leyi (2009). Olaiya akt inside Agunbaniro. In 2003,;im nem dey di list of Aktres wey du wel for di katigori Reel Award Best Supporting Aktress of the Year, an shi win di Best New Actress Award.In 2016, Olaiya rilise one fim wey e nem na Iya Okomi wey Foluke Daramola an Funsho Adeolu folo akt inside.

Ha persons life tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Olaiya mari Bayo Okesola in 2007 bot leta Si marenj skata. Shi komot fom kristen to Islam in 2014. Olaiya dai on May 17, 2017 fom hart attack for Kanada. Olaiya dai two month afta e bon e sekod Pikin. Dey beri am on June 7, 2017 di way moslim dey beri dead bodi.

Fims wey shi dey[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Aje nile Olokun
  • Ojiji Aye
  • Apaadi
  • Omo Iya Meta leyi (2009)
  • Nkan adun (2008)
  • Sade Blade (2005)