Mohamed Bazoum

From Wikipedia

Mohamed Bazoum ( dey bon am 1 January 1960) na Niger politishan wey bi di nomba 10 presidet of Niger from 2021 go rish 2023. Bazoum enta as presidet of Niger in April 2021 winin di 2020-2021 Nigerian Jeneral eleshon an e eskep one plan to komit am from presidet by force (2021 Coup. Dey finali komot am with force (Coup) in di 2023 Nigerien coup wey solja wey dey protet presidet an e solja kari out. Na Abdourahamane Tchiani lid di coup. Bifor Bazoum bikom Nigeria presidet, e na presidet of Nigerien Parti for Demokrasi an Socialism (PNDS-Tarayya). Na Bazoum bi di Minista of Forin Hafihas from 1995 go rish 1996 an e stil do di wok again from 2011 go rish 2016.

Bazoum stil do Minista of Stet at di Presidensi for smol time in 2016 an e do Minista of Stet for interiho bitwin 2016 onti e bikom Niger presidet in 2021.

Na 55.67 paset (%) of di pipo wey vote vote for Bazoum in di 2021 eleshon. Dat nomba of pipo wey vote for am mek am fit win di forma Niger presidet Mahamane Ousmane.

Bazoum bi di fest memba of smol Arabs tribe Ouled Slimane Pipo wey bikom di presidet of Niger.

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Bilabrin, French, Niger dey bon Mohamed Bazoum in 1960. Bilabrin vilej todey dey Diffa Rijion of Niger. Na for Tesker town wey de 200 kilomita from Bilabrin e tek gro up.

Bazoum go pamari skul wey de Goure an e stil go Amadou-Kouran-Daga sekondri skul (lycée Amadou-Kouran-Daga). Bazoum rid Filosofi at Cheik Anta Diop Yunivasiti ( pipo dey also kol am Yunivasiti of Dakar) wey de Senegal from 1979 go rish 1984. Bazoum do e Masta digree in Politikal an Moral Filosofi at di Yunivasiti of Dakar. E do diploma in Logic an Epistemology.

Afta wey Bazoum finish Yunivasiti, e tich for meni sekondri skul for six years. E join SNEN ( Nashonal Union of Tisha of Niger). Bazoum stil join USTN (Trade Union of Workas of Niger) an e go stand for dem at di 1991 Nashonal Konferens.

How dey tek komot am for president[chenj-am | chenj-am for orijin]

On 26 July 2023, solja-dem wey de protet presidet onda di komand of Jeneral Abdourahamane Tchiani block di presidential palas an komot Bazoum from di sit of presidet. African Union an ECOWAS (Ekonomik Kommuniti of West Afrika Stet no sopot wetin dos solja do. ECOWAS tok sey mek di solja rilis Bazoum kwik-kwik. Mejor Amadou Abdramane leta tok on T.V sey dem don komot Bazoum as presidet of Niger an na Tchiani bi dia presidet now. Dey nem dia niu parti Nashonal Kansu for di Safeguard of di Homeland. Some niuz tok sey Bazoum don plan to komot Tchiani for one mittin wey e do with e kabinet on 24 July bikos of wetin dey happun bitwin dem.

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bazoum wife na Hadiza Mabrouk Bazoum. Dey get four pikin.