Miss Universe Nigeria

From Wikipedia

Miss Universe Nigeria (MUN) na one Naija beauti pajent wey dey hapun evri year. Di pajent na to pik who go go repiset for di Miss Universe. Na Silverbird prodoshon dey arenj Miss Universe Nigeria. Silverbird start dis pajent in 1983. Di sho stop for som time, but kom bak in 2023.

Di pesin wey win di las Miss Universe Nigeria na Hannah Iribhogbe. Na September 2023 e go rimuv e taitu, and MUN go kom riples MBGN

History[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bifor bifor, na Daily Times pipo dey arenj Miss Nigeria pajent wey dey kari pesin go Miss Universe. Afta Edna Park wey bi Miss Nigeria 1964 wey Daily Times pipo kari go Miss Universe fall dia hand for semi-final, dem stop to dey kari pesin go Miss Universe.

For 1983, afta dem do plenti annasimet, [1] Omololu Ojehomon win di niu Silverbird beauti pajent "Miss Universe Nigeria", but di fest edishon no gud bikos dem rimuv Ojehomon taitu komot bifor e get opotuniti to go oyinbo kontri go do Miss Universe. For dat niu Miss Universe Nigeria, na Yemi Fawaz kari di nomba 3 posishon, an e tok sey Silverbird no arenj di pajent wel wel. Pipo kom dey tok bad about di sho bikos of how Silverbird tek chuz two pipo to get sekod posishon. Anoda wahala for di sho dat time bi sey, enibodi wey e mama an papa no kom from Naija no go fit bi winna. Fawaz stil tok sey wetin dey vex am pass bi sey Silverbird no dey tekia of pipo wey don win di sho awod afta dia year don finish.

After three years reach, Silverbird president Ben Murray-Bruce bring back di pajent as Most Beautiful Girl in Nigeria, and na Law student Lynda Chuba-Ikpeazu win am come do Miss Universe for di first time since 23 years.[2] MBGN come get more franchise like Miss World, Miss International, and Miss Supranational, but na only those wey win MBGN fit represent Nigeria abroad. Agbani Darego wey study Computer Science and Mathematics win Miss World for 2001, and na she become di first Nigerian wey place for Miss Universe that year.[3]

For 2005, Silverbird create different title for MBGN runners-up dem, like MBGN Universe, and MBGN winner pata pata na "MBGN World"; na only Miss World she fit go. Roseline Amusu wey been study Human Science, na she become di first MBGN Universe, but Nigeria no fit place until 2019 when Olutosin Araromi wey dey study Health and Human Services come reach Miss Universe top 20 after 18-years reach.[4]

For 2023, Silverbird come bring back Miss Universe Nigeria, and na Murray-Bruce brother, Guy, talk say Miss Universe rules dey change evri time, na 'im make MUN and MBGN na two different pajent now. MBGN dey promote dat kin' beauty wey Oyinbo too dey like, but, MUN dey accept every contestant, and dem marital status, body type, shade, height or weight no be problem again.[5] [6]

  1. "Ben Murray Bruce". MTVBase Meets. Archived from the original on 18 June 2015. Retrieved 2015-06-17.
  2. Who Fathered Lynda Chuba's Twins?
  3. Agbani Darego Marks 20th Anniversary of Winning Miss World
  4. Silky Olutosin Araromi at Miss Universe
  5. 35 Years After, Silverbird Group Unbundles MBGN
  6. Miss Universe 2023 Now For All Women