Mercy Johnson

From Wikipedia

Mercy Johnson Okojie (dem bon am for 28 August 1984) na Naija aktres, fim dareto an fim produsa. E go skul for Riva Stet sekondari skul.Mercy Johnson leta kom go Naijiria Navi sekondiri skul for Port Harcourt in Riva stet. Afta e sekondiri skul, Mercy go for ordishon for di rol inside di fim "The Maid" an e stil akt for meni oda fim dem like Hustlers, Baby Oku for America, War in the Palace.

Tori abaut e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Okene wey dey Kogi Stet na im Mercy Johnson Okojie tek kom fom.Na for Legos dem bon Mercy an e papa na Navi ofisa wey e nem na Daniel Johnson an e mama nem na Elizabeth. Mercy bi di nomba four pikin amog di seven pikin wey e paret bon.E stat e pramari skul for Kalaba wey dey Kross Riva Stet.Na fom Kalaba dey tek transfa Mercy papa kom Legos Stet as a Navi ofisa an Mercy kom kontiniu e edukeshion wey dey Naijiria Navi skul in Legos. As time dey go, e du e sekondiri skul for Riva Stet sekondiri skul bot leta finish e sekondari skul for Naijiria Navi sekondiri skul Port Harcourt inside Riva Stet.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta Mercy finish sekondiri skul, E go ordishon wey dem giv am di rol wey e akt for di fim kol "The Maid", apat fom dis fim e don akt for meni meni fim-dem like Hustlers, Baby Oku in America, War in di Palace. For 2009, Mercy win awod for Best Soportin Aktres for di 2009 Afrika movi awod seremoni for e pafomas for di movi "Live to Remember" an Best Aktres awod for di 2013 Africa Magic Viewers Choice Awards for e rol for di komedi fim "Dumebi di Dirty Gel". For December 2011, dem put Mercy nem as Google's most search for Naija Selebriti an for 2012 na im stil bi di most search again. For April 1 2017, Mercy kolet di posishon of sinior spesha Assistant (SSA) to kogi Stet govanor for entatainmet, akts an Kolsho. Mercy Johnson d y amog di pipul wey dem stop fom aktin bikos dia moni too high an for Novemba 3 2013, di movi Maketa of Nollywood dem vex sotey dem sef sey dem no go gri am akt again for di indostrie bikos of di sem risin.Di pipul wey dis tin happun to na Genevieve Nnaji, Omotola Jalade Ekeinde, Richard Mofe Damijo, Emeka Ike, Ramsey Nouah, Kkem Owoh, Stella Damasus an Jim lyk, dem stop fom aktin bikos of hi diman for moni for one movi. But di maketa an produsa dem for March 9,2014 kom tok sey dem rimuv di ban bikos di aktres an akto dem kom beg dem sey mek dem no too vex sey dem no go du like dat again. Mercy mek e fest fim as fim produsa wit di fim "The Legend of lnikpi"

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Mercy mari prince Odianosen Okojie on 27 August 2011. Dem get four pikin-dem.

Kompini wey e don wok wit[chenj-am | chenj-am for orijin]

For October 2019, Mercy Johnson sign deal wit Chi limited Prime Brand, "Hollandia Evap Milk". E stil bi brand ambassador for "Pennek Nigeria limited" wey bi real estate investments kompini wey dey Lagos.