Mejai Bola Avoseh
| Man abi wuman | man |
|---|---|
| Wok wey e dey du | profeso |
| Wu e dey wok for | South Dakota |
| Wie e go skul | University of South Dakota |
| Awod wey e kolet | Fulbright Scholarship |
Mejai Bola Mike Avoseh na one big ticha wey dem dey kol profeso for insaid one big skul wey di nem na University of South Dakota. Di men tins wey e dey tich pipul na hau big pipul wey don gro dey len buk, hau difren difren pipul for di wold dey du dia tins, an mata wey konsan difren said for di wold. Avoseh don dey among di pipul wey dey lid wey dey kontro di big grup wey dem dey kol American Association for Adult and Continuing Education (AAACE) sins 2016, an e stil wok for anoda grup wey di nem na International Society for Comparative Adult Education (ISCAE) from 2020 rich 2023. E stil bi di men chiaman for di branch wey dem dey kol ''Commission for International Adult Education (CIAE) wey dey insaid dat AAACE grup.[1]
Hau e tek go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Avoseh get im first big skul satifiket for 1982 an e get anoda satifiket wey big pas di first one for hau pipul dey tink abaut laif wey dem dey kol Philosophy for 1984. E kom stil get one speshal buk learning pepa for hau to tich skul for 1987 an di skul satifiket wey big pas wey bi Doctor of Philosophy (Ph.D.) for insaid di mata of hau big pipul wey don gro dey len buk for 1991. Avoseh get ol dis skul satifiket-dem from di big skul wey bi University of Ibadan. E stil go anoda skul go get one big satifiket wey dem dey kol Master of Science in Educational Leadership and Administration from di College of Saint Rose for insaid one taun wey di nem na Albany for 2006. Avoseh na pesin wey get konfam satifiket to tich eni pikin from smol skul rich big sekondri skul, an e bi sinio buk woka for insaid Niu York Stet. E stil get oda speshal satifiket-dem to kontro skul mata wey bi SAS (School Administrator and Supervisor) an SDA (School District Administrator).
Hau e tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]From 1986 rich 1995, Avoseh dey tich big pipul buk as asistant profeso for di branch wey dey luk afta hau big pipul dey len buk for insaid University of Ibadan, an e stil tich for Saints Peter and Paul Seminary wey dey for Ibadan. Afta dat one pas, e travu go tich for di University of Namibia from 1998 rich 1991. From dat ples, e muv go America go tich insaid di New York City Public School System from 2001 rich 2004. Di pipul wey dey lid chuz am mek e bi asistant profeso for University of South Dakota for 2004, an leta dem mek am ful profeso for 2015.
Avoseh don rili du big wok wel-wel an e don tich for difren difren mata wey konsan hau big pipul dey len buk, espeshali hau big pipul dey rizin tin, hau to du koret tins for evribodi, di way to tich skul, an hau pipul dey len buk for difren kontri-dem. E don tich an du dip risach for insaid Nigeria, Namibia, United States, an Botswana, wia e wok as one speshal intanashona buk pesin wey dem dey kol Fulbright Scholar.
For 2019, dem giv am one big respet awod wey dem dey kol Outstanding Service Medallion from di American Association for Adult and Continuing Education (AAACE). Avoseh don kolet di big America scholarship respet awod wey di nem na J. William Fulbright Core Award for U.S. Scholars two taims bikos of hau e tich an du dip risach. Di las Fulbrait awod wey e kolet na for Mach 2019 mek e for tich an du dip risach insaid Naija.
As pipul si sey e don hep wel-wel for di mata of hau big pipul dey len buk, for Setemba 2021 dem chuz Avoseh enta di big haus of respet wey dem dey kol International Adult and Continuing Education (IACE) Hall of Fame, an dem put am insaid di grup for koret way for Oktoba 6, 2021. E don rait plenti buk-dem an big big skul pepa-dem abaut hau big pipul dey len buk, hau difren kontri-dem dey du dia skul, hau pipul dey muv from one kontri to anoda, hau to mek smol taun-dem fain, hau to rid an rait, human kolsho, boi-an-gel mata-dem, an govment rul-dem for skul. One pat wey e rait insaid one buk wey di nem na Africa and Lifelong Learning don go far wel-wel an plenti oda buk pipul dey luk wetin e rait tek du dia own wok.