Mayen Adetiba
Mayen Adetiba (bon 1954) na Naija aktress wey leta turn to ogbonge civil engineer.
Life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Adetiba for 1954 for Naija.Shi fess won bikom an accountant, but shi leta chenj ha mind to bikom journalists.Shi wok on "The Bar Beach Show" wey shi pley di rol of Lakunle Ojo's wife for The Village Headmaster. Shi dey inside Kongi's Harvest wey dem rilis for 1980. Shi komot Naija go du ha edukashon for USA and as shi dey go skul na shi still dey wok bikos ha parent no fit send ha moni bikos of export restrictions. Shi fess go New York University bifor shi transfer go Columbia University go stodi electrical engineering. Dem tell ha sey civil engineering dey more appreciated for Afrika na why shi chenj ha mind.As shi chenj mind go studi Civil Engineering for Columbia University shi mit oda Naija guys there as shi bi di onli blak female wey dey stodi di course, as shi finish for there.shi kon go du ha master's digree for Cornell University. Shi marri Dele Adetiba an dem bon Kemi Adetiba for Legos for January 1980. Dem elekt ha as di President of di Association of Consulting Engineers of of Nigeria an shi bi forma Vice-President of di Nigerian Society of Engineers three times .Shi bi di fess wuman wey dem elekt as an Executive Committee of di Nigerian Society of Engineers. Shi du som wok for ha karia like di Afrikan Union Southern Africa Regional Office wey dey Malawi an di big Summerhill Baptist Church for Legos. Shi wok on di latter pro bono too. For 2017 shi kom ha pikin show "King Wumen" wey ha pikin Kemi Adetiba interview ha with oda "King Wumen" like Chigul, Taiwo Ajai-Lycett, TY Bello an Tara Durotoye