Jump to content

Maud Cuney

From Wikipedia

==Maud Cuney==(e papa nem na Cuney, February 16,1874-February 13 or 14 1936) na one Amerika pesin wey dey play Piano an wey stodi Muzik,raita an shi dey fait for di right of Afrika-Amerika pipul wey dey for Boston, Massachusetts for United States.Sem bon am for Galveston.Shi bi di girl-pikin of Norris Wright Cuney wey bi Lida of pipul wey dey fait for pipul right an na e bi Oga of Texas Republican Party for di Reconstruction Era.Na Adelina(e papa nem bi Dowdie) wey bi skul Tisha bi e waif. For 1913,Cuney -Hare poblish di Tori of hau E papa Liv E Laif. Afta dem get freedom,Cuney Hare stodi for di niu Ingland Conservatory mizik for Boston an kom ton to pesin wey dey play Piano wey hey levul wel-wel. Na for Jamaika Plain wey dey Nia Boston.Shi Liv most of e Laif. Bikos sey shi stodi Muzik ,shi kolet plenti Muzik of South an Carribean as shi dey stodi folklore,an na shi bi di first pesin to stodi Creolemuzik. Meni pipul dey remeba e last weekend wey shi kol Negro Muzishan dem an Dia Muzik(Negro Musicians and Their Music)(1936)wey shi yuz tek rait abaut Afrika an Amerika pipul muzik dem.

Hau Shi Liv E Laif an go Skul wen shi dey Smol-pikin

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Maud for Galveston,Texas for February 16,1874, to Adelina(Dowdy,or Dowdie if we spel am for anoda way) an Norris Wright Cuney e hosband. E papa an Mama dem kom from white pipul an black pipul famili dem-E papa na one white pesin wey get levul wel-wel for famili an e mama na wuman wey fine like man from Woodville,Mississippi. Dia orijin na from Afrika,India,Europe an Swiss-Amerika pipul dem. Dia famili wey get moni wel-wel an get levul for politik wey Gen.Phillip Minor Cuney of Austin County,Texas wey send bon from e Louisiana. Norris Cuney na one of di eight(8)pikin wey Cuney an Adelina Staut e Hauskipa bon. Phillip Cuney mek e pikin dem on Staut free bifor di Civil war. Araund 1850,Cuney bi one of di pipul wey get big farm dem an pesin wey get slave for Texas.E farm na 2000 acred an e get pas 100 slave dem. E waif dem wey bi Oyinbo bon Eight(8) pikin,Eliza(Ware) Cuney wey bi e sekond waif bon tree(3) pikin bot shi quik Kpai, e third(3) wife Adeline(Spurlock) Cuney bon five(5) pikin dem. Phillip Cuney Kari e boy-pikin,Joseph an Norris dem go Pittsburgh, Pennsylvania, mek dem dey dia dey go skul bifor dem stat di war. Afta som time Norris go wok inside difren-difren boat dem for Mississippi River bot afta dem end di war,e kom ton Lida for Texas Republican Party.