Jump to content

Maryam Yahaya

From Wikipedia

Maryam Yahaya (dem bon am for 17 July 1997) na Naija aktres wey dey akt Hausa fims in Naija. Yahaya kom fom Kano Stet. Shi bikom popula bikos of di rol wey shi akt inside di fim wey di nem na "Taraddadi" wey Elnass Ajenda daret. Bikos of dat fim e nem dey di katigori for best promisin aktress by City People Entertainment Awards for 2017. Dey stil put e nem for di katigori for best aktress by City People Entertainment Awards for 2018

How e tek wok

[chenj-am]

Yahaya bin won bikom aktress fom smol evri time shi dey luk Hausa.Shi akt im fest fim wey di nem na Gidan Abinci, Barauniya an Tabo, wey shi du smol smol rol inside. Shi bikom popula afta shi akt as Bilkisu Shema in Mansoor wey Ali Nuhu daret.