Maryam Booth

From Wikipedia

Maryam Ado Mohammed wey pipu sabi as Maryam Booth ( bon October 28, 1993) na [Naijá]] aktres an Model.Maryam kom from Kano Stet.Shi bikom popula bikos of di rol wey shi akt inside one fim wey di nem na The Milkmaid (film) (2020) an na dis fim dey pik fom Naijá for di Best International Feature Category for di Academy Awod for ha rol as Zainab inside di fim, Maryam win di Africa Movie Academy Award for di best aktress in a sopotin rol.

how shi tek stat life and skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na October 28,1993 dey bon Maryam for Kano Stet. Shi an im mama wit two of im famili memba self bi pofeshonal aktos. For one intaview wit BellaNaija, Maryam tok sey e don dey akt sice e dey 8 yes old.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Maryam bi di MC for di 2019 edishon of di best of Nollywood Awods. For 2020, Maryam win di best sopotin aktress katigori for di Africa Movie Academy Awards.