Mary Winslow Smyth

From Wikipedia

Mary Winslow Smyth ( dey bon am March 26, 1873 an e kpai in 1937) na Amerika wuman wey dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way an e stil dey kolet tradishonal song-dem in di heli 20 senturi.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Bangor, Maine dey bon Mary Winslow Smyth on March 26, 1873. Smyth gra-pa na professor for Bowdoin Kolej.Smyth mama kom from old-line Bangor an dorin dry sisin r sry stry Islesford, Maine. Smyth finish from Smith Kolej in 1895. Na for 1897, Smyth kolet e Masta satifiket. Smyth get e Ph.D satifiket in Inglish from Yale Yunivasiti in 1905. E stil wok as Hassosiate professor at Elmira Kolej from 1922 to 1924. E fest dey kolet an kip tradishonal song on e own bifor e kom join bodi wit Fannie Hardy Eckstorm. Fannie Hardy Eckstorm na pesin wey de stock an rekod how dem dey du tins for lokal way too. Smyth join bodi wit Fannie Eckstorm to rait an rilis di 1927 buk " Minstrelsy of Maine: Folk-Songs and Ballads of the woods and the Coast". Smyth dey gada tradishonal song from pipul wey dey stey for wata-side. Half of di tins dem wey de inside di buk kom from di wata-side pipul-dem (E patna faze pipul wey dey cut wood an pipul wey no de wata-side)

Phillips Barry rili like di wok wey Smyth an Eckstorm dey du, an e wok wit dem. Dia sekod buk, "British Ballads from Maine: The Development of Popular songs with Texts and Airs" (1929) add Barry as one of di editor. If sey di way all of dem tek wok bring beta risot, Smyth no too hapi sey dey add Barry as editor for di buk. E tok sey even if Barry wok for di buk, e wok for di buk no rish for dem to add am as editor, an sey na bikos of di big skul wey e go an bikos of e na man na e mek di poblisha of di buk add e nem.


Smyth sabi rekod an kip song an e na beta risasha. Wen e tok abaut e wok for one niuz-pepa kol Bangor Daily News, e tok abaut di hard wok, pasiens, an luck wey all of dem ( Smyth, Eckstorm) put for dia wok to get beta risot. Akordin to Symth, e tok sey Meni pipul dey wonda if dey tok sey dey wan lisin an rekod dia old song. So Smyth an di odas nid to play wit dem fest, win dia trust bifor pipul go gri give or sing to dem.