Mary Hayes Davis

From Wikipedia

Mary Hayes Davis (dey bon am araund 1884 an e kpai May 18, 1948) na Amerika raita, Niuz-pepa editor, an a poblisha. Davis get meni fims tihata. Meni pipul sabi Davis bikos e join bodi wit Chow Leung to rait di buk Chinese Fables and Folk Stories. Na wen Chow Leung de Chicago dey stat to rait di buk. Na for 1908 dey poblish di buk an pipul wey mek di buk tok sey di buk na di fest buk wey get Chinese tori wey dey yuz Inglish print. Meni pipul don ri-print di buk. From 1908 go rish 1912, Davis kolet Native Amerika tradishonal tori wey Pima pipul an Apache pipul tok to rait di buk wey e stil dey wok on. Pima an Apache pipul dey stey Oklahoma an Arizona side of Amerika. Davis pak to live for Southwest Florida an na for dia e tek poblish "The Hendry County News" an e stil get an kontro Seven fim tihata. In 1926, "The Tampa Tribune" kol Davis strong wuman of LaBelle as e no fear to ripot di killin of Henry Patterson even as bad pipul tok sey dey go sho am shege if e tok am. Dey give e Niuz-pepa, The Henry County News di Florida Niuz-pepa Assosiashon awod for Best Komuniti Niuz Davis in 1928. Di fim Tihata Dixie Kirsta Tihata wey Davis Opun in 1941 de di list of Nashonal Rejista of Historik Ples

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na araund 1884 dey bon Mary Hayes Davis in West Virginia. E dey stey for farm. Davis also live in Kansas. Davis onli yuz one year for kolej. Na e hosband fest kpai bifor e sef kpai.

Chinese tori an tradishonal tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1900, wen e stil dey len in Chicago, Davis get one job to bi riporta an to dey rait for one popular niuz-pepa wey dey kom out evri day. Bikos of di riportin wok, e get to no pipul from Chinatown, Shikago. Pipul wey e mit inklud Pastor Chow Leung. Chow Leung bi di pastor of di Senta Baptist Chinese Mission.