Martha Nelson Thomas

From Wikipedia

Martha Nelson Thomas(dem bon Martha Marie Nelson,for November 29,1950-May26,2013)na one Amerika folk artist,wey plenti pipul know sey na Soft Skupsho wok shi dey do. Na Thomas kriet "Doll Babies" wey dem yuz for Cabbage Patch Kids.

Im Baografi[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Martha Nelson for Princeton, Kentucky.Im papa an mama nem na Ralp an Ernestine Nelson.Wen shi stil smol, Im famili muv go Mayfield, Kentucky. Na for Louisville School of Art shi graduet.Martha Nelson mari Tucker Thomas for October 10,1981.Dem kom bon three pikin dem ,Seth,Carl an Mara.Martha na sista to Albert Nelson wey dey stey for Louisville an dey kav ston for dia. For 1971 wen shi stil bi student,Thomas stat to dey pratis to dey do smol-smol doll dem for Soft Skupsho. Na wetin smol-smol pikin dem dey do shi dey tek do di Doll BabiesNa hand shi dey tek do di wok an dey sell am for Craft Fairs araund Louisville, Kentucky. For 1976,Thomas mit Xavier Roberts for for one of di Cratf Fairs dem.Xavier tel Thomas sey mek shi soplai plenti doll dem wey dem go sel for Georgia,wie Im dey Liv an dey wok.Thomas alau am to dey sel di Doll Babies dem for some taim bot shi kom stop Roberts sef kom stat im own vashon for 1978, and for im kolet laisens for di dolls and kom tel Coleco to do am pleti and Im kom kol am Cabbage Patch Kids For 1979, Thomas Kari Roberts go court for di fest time.By 1983, shi stat to find hau Roberts go tek pey am $1 million for damej dem.For 1984, dem setul di mata bai dem sef and dem no go courtagen bot no bodi know hau mosh dem tek setul di mata.Araund dis time, Cabbage Patch Kids don popula so tey pipul dey buk and dey wait for di doll dem for like nine- month.Thomas sel meni of im wok tru Fibre-Craft wey bi like Im orijina Doll Babieswey alau kostoma to dey sow dia own doll.For dat time dem don dey sel Cabbage Patch Kids for $30- $150;di totaDoll Babieswey Thomas dey sel kost abuat $16.Afta di courtkes Martha kontiniu to dey kriat art truaut im life. Some of im projet dem inklud toy wey shi do from di tins dem wey im pikin dem draw and som wey shi yuz socks tek do. Martha and im famili sel al dis tins wey shi kriat dem for Loka kratf fairs. Martha try wel wel tek sopot mek smol pikin dem luv art.Shi bi artist wey dey stey for smol pikin elementri skul and shi do plenti workshop dem wit di loka girl skaut demand oda oganaizeshon dem. Thomas dai for Louisville, Kentucky on May 26,2013 afta shi batul wit Ovarian Kansa. Dem ezibit im wok dem for High Museum of Art

Refrens Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Martha Nelson

"Thomas Obituary"- LOUISVILLE,KY1 ObitTree May5,2019.

2.Custody' fight over Cabbage Patch dolls Christian Science Monitor December12,1983.

3.Piro Lauren(April-2015) "The Not-So-Sweet Truth about Cabbage Patch Kids Good Housekeeping

4."Sewing Up the Doll Market. Washingt Post December 6,1984

5."Way Out There: The Art of Southern Backroads High Museum of Art.