Marie Hassenpflug

From Wikipedia
Marie Hassenpflug
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromElectorate of Hesse Chenj-am
Fest nemMarie Chenj-am
Famili nemHassenpflug Chenj-am
Wen dem bon am27 December 1788 Chenj-am
Ples wey dem bon amAltenhaßlau Chenj-am
Wen e kpai21 November 1856 Chenj-am
Place of deathKassel Chenj-am
PapaJohannes Hassenpflug Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokGerman Chenj-am
Wok wey e dey dufolklorist Chenj-am

Marie Magdalene Elizabeth Hassenpflug (dem bon 27 December 1788 an e kpai on 21 November 1856) na German raita wey plenti of e tradishonal tori dey inside di koleshon of tori wey [[Brothers Grimm| Brodas Grimm] poblish. Pipul sabi am for e tori like "Little Red Riding hood", "Sleeping Beauty" an Snow White

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Ortsteil AltenjaBlau of Linsengericht aria in Landgrafschaft Hessen-Darmstadt of Holi Roman Empaya dey bon Marie Magdalene Elizabeth Hassenpflug on December 27, 1788. Hassenpflug papa Johannes Hassenpflug (1755-1834) mari Hassenpflug mama Marie Magdalena Dresen (1767-1840). E mama kom from di Huguenot famili wey dey stey in Hanau. For October 14, 1789, e famili pak go a house wey pipul dey kol "Haus Lossow" wey near maket korna of LindenstraBe in Neustadt. Hassenpflug famili pak go dia bikos dey mek e papa di hed of a di town Neustadt-Hanau. Hassenpflug gro up in dat house an na dat di famili stey onti 1799. Hassenpflug get two sista an one broda. Di nem of di two sista na Jeanette an Amalie. Di nem of e onli broda na Hans Ludwig Alexander. Hassenpflug na sikla wen e dey skol an one pesin wey no buk wel wel Heinz Rölleke tok sey dis one fit don mek am luv tradishonal tori bikos na bed e dey always stey. Na bikos e bi padi or frend wit Engelhards famili na e mek am get link to bi frend wit di Grimm famili. Hassenpflug onli broda Ludwig mari Charlotte Grimm. Charlotte Grimm bi di yonga sista of di Brodas Grimm.

On 15 April 1799, Hassenpflug famili pak go Kassel bikos dey transfa e papa an give am posishon of finashal Supavasor of di Landgrafschaft Hassen-Kassel. Marie Hassenpflug mari Friedrich von Dalwigk zu Schauenburg. E hosband stey for "Hanau" as di kaptain of di Kurprinz rigimet. Hassenpflug live for e hosband estate in "Hoof" ( di niu nem for Hoof now na Schauenburg) an in Hanau. Na for Hanau dey bon dia boi Ludwig Alexander. Hassenpflug bon Ludwig Alexander on 24 January 1817.

From 1819 go rish 1824, Hassenpflug serve as pesin wet dey hep Herzogin Marie Friederike von Anhalt Bernburg wey Hi di gel-pikin of Langraf an leta Kurfürst Wilhelm IX/I of Hesse-Kassel.