Marie Clothilde Balfour

From Wikipedia

Marie Clothilde Balfour ( dem bon am October 20, 1862 an e kpai on September 1931) na Bristish wuman wey bi raita, transletor, an pesin wey dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way. Balfour rait three novel, rait some tori, an play-dem, e yuz song tek translet how pesin dey feel ( poetry) an French Revolution-era memoir ; e kolet an rekof tradishonal tori an muzik, e stil translet two big leta-dem wey kom from e anti.

How e tek stat life an go skul=[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Edinburgh dey bon Balfour. E na di gel-pikin of James Balfour an Christina Simson Balfour ( e leta chenj nem to Nicholson). James Balfour wey bi e papa na enjinia. Di raita Robert Loius Stevenson bi Balfour fest kosin. Balfour stat e life for New Zealand as e papa dey wok for dia dat time.Wen Balfour papa kpai for 1869, e go bak to Scotland wit e mama. Balfour rait three novel, e translet one French Revolution wey bi era memoir, an e edit two volume of leta wey e anti Margaret Isabella Balfour Stevenson rait, wey e send wen e travul wit ha son go Polynesia. Balfour rait play dem, an tori dem an rait som buk abaut tradishon. Na from time to time won pisin wey bi buk espat no dey shuor abaut di orijinaliti of di stori wey Marie Clothilde Balfour tok sey shi rait, bikos di stori dem wey shi rait dey strenj an shi add ha own simpu an eezi way tu ondastand.

Buk Dem wey shi don Rait[chenj-am | chenj-am for orijin]

1.Legends of the Cars (1891, a series of articles)

2.White Sand (1896, novel)

3.Maris Stella (1896, novel)

4.Sub Tegmine Fagi (1897, short story)

5.The Fall of the Sparrow (1897, novel)

6. Saint Joseph and Mary, from a French folk song" (1897, poem translated by Balfour)

7.From Saranac to the Marquesas and beyond; being letters written by Mrs. M. I. Stevenson during 1887–88, to her sister, Jane Whyte Balfour (1903, edited by Balfour)

8.Examples of printed folk-lore concerning Northumberland (1904, collected folksongs) Memoirs of Mlle des Écherolles, being sidelights on the Reign of Terror (1904, translated by Balfour)

Im Pasona Laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Balfour mari ha fest kohsin, wey bi fisishian James Craig Balfour dey kom get won dohta, wey e nem na Marie Margaret Melville Balfour, shi tu leta bekom pesin wey dey de rait. Balfour hosband kom dai for 1907, an shi dai for 1931 for London.

Wie Dem Gada di Tori[chenj-am | chenj-am for orijin]