Mariama Mamane

From Wikipedia

Mariama Mamane na Niger wuman wey dey wok to protet di envaromet an e stil bi enjinia. Na Maname fom di Jacigreen kompini an di kompini don kolet meni awod for di wey e dey do to klin riva an wota-side.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for near Niger Riva wey de Niamey Mamane tek gro up. E mama na pesin wey get Masta digri in life and earth science. As at 2020, Mamane dey stey in Burkina Faso. Mamane get digri in biodiversity an envaromet manejimet from Yunivasiti of Niamey.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2016, Mamane win di Entrepreneurial Journey prize from di International Institute for Water and Environmental Engineering ( dey no di organesahon as 2iE). Na Mamane fom di kompini Jacigreen an e rejista di kompini in Ouagadougou. Jacigreen dey wok on one plant wey dey plenti for riva side wey bi hyacinth to fertalaza, manior, an bio-gas. Dem dey yuz dis bio-gas as petirol inside jenerator to get light or eletrisiti. Mamane win di United Nations Environment Programme Young Champions of the Earth Prize in 2007. Di prize rish 15,000 dollas.