Maria Paula Survilla

From Wikipedia

==Maria Paula Survilla==(February 1, 1964-April 25, 2020)pipul even dey kol am Paulina Survilla,na one Amerika pesin bi Profeso for di stodi of difren-difren kolsho Muzik an hau Dem rezembul dem sef(ethnomusicoloy)an stil bi pesin wey dey fight for di rait of Belarusia pipul dem.

Tori abaut E Laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Janka an Ivonka Survilla dem bon am for Madrid,Spain.Di two of dem dey tok again pipul wey dey fait for Komunis dem an dem komot for Belarus bikos of di wahala wey sekond Wold War kos. Dem muv go France, stay dia for some time ,kom stil muv go Spain.Bikos Paula mama like to dey learn niu-niu langwej dem,shi sef kom stat to dey learn difren-difren langwej dem sotey e kom Sabi spik French, Spanish an Belarusian langwej wel-wel wen shi stil bi smol-pikin.

Wen Shi stil bi Smol-pikin[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen shi bi five yias old,e famili muv go Canada an shi kom stil learn Inglish as e nomba four langwej wen shi dey for skul.Joz as e mama dey difend Belarus Kolsho, Survilla sef kom ton to pesin wey dey fait for pipul right wen shi bi smol-pikin.Shi even stat one grup wey shi kol Youth Canadian Ethnocultural Council an shi bi di shia-pesin. Wen shi dey for Yunifasiti of Ottawa,shi stodi difren-difren pipul Kolsho Muzik an hau dem rezembul demsef(ethnomusicology), an kom graduet wit B.A ontop Muzik(Clarinet1987) an shi kom bikom memba of di Governor General Foot Guards Band.Shi even do di wok of pesin wey dey gaid pipul dey tour an dey show visitos dem difren-difren tins wey dey for di Parliamentan inside Govno Genera kompand.

Pipul Wey Sabi Buk Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1987 Survilla Mari Eric Wachmann an dem muv go Ann Arbor Michigan, so shi kom stat wok ontop e M.A digri for di Yunifasiti of Michigan. Wen shi dey do e Masters, di tins wey shi rait tek difend e wok (thesis) naim shi kol Music and Identity: Byelorussian making music in North America. For 1991,dem giv Survilla shans to dey go skul for free(Scholarship) an dis gift kom mek am for do orijina risash ontop Bialystok, Poland an Belarus. At las di wok kom stil gov am anoda shans to tek rait plenti-tins(dissertation) ontop Mermaids an Rock Singers an dis wok wey shi rait mek dem giv am e PhD for pesin wey stodi difren-difren Kolsho Muzik an hau Dem rezembul demsef (Ethnomusicology) for di Yunifasiti of Michigan.