Jump to content

Maria Leach

From Wikipedia

Maria Leach (dey bon for 30 April 1892 an e kpai on 22 May 1977)na one raita an editor of buk-dem wey konsain tradishona tori-dem of di wold. As Leach sabi buk wel wel, e gada tradishona tori wey tok about old pipo, yong pipo an smol smol pikin. Na thirteen (13) buk e don rait.

Tori of e life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for New York siti dem bon Maria Leach. Bifor-bifor, di nem wey Maria Leach dey ansa na Alice-Mary Doane. Leach na gel-pikin of Benjamin H.Doane an Mary (Davis) Doane. Leach fada kom from Nova Scotia,one of di three maritime aria wey dem for Canada. Na for Barrington,for Shelburne kontri naim dem bon di man. Leach papa bi kom from one venerablefamili wey dem dey kol Doane(one Anglicizedfom of Gaclic nem wey komon for Southern Ireland sins 1500 yias dem) For Nova Scotia, Leach get koneshon to travul for big wota bikos of sey e papa na kaptain for ship. For lait 1870 or eli 1880 dem, Benjamin Doane an im waif Mary, wey kom from one nati South Carolina muv go New York an start to dey live inside Manhattan. Na Manhattan dem de for meni yias bifor dem bon dia pikin. Leach gro up an do im eli edukehon for New York siti. Wen e finish from sekondri skul, Leach go Earlham Kolej for Richmond, Indiana wey di korikulom folo di tins wey dey for Rilijon Sosaiti of Frend dem (Quakers). Leach kom go stodi for im Masta digri for authtropology for di Yunifasiti of Illinois inside Urbana-Champaign. Na for dia e mit MacEdward Leach, wey bi studet of medievallitresho an filosofi an wey kom get intres for tradishona tori. E like Oral tradition of medieval folklore jos like Mari ("Ma-RYE-uh" as dem dey kol am for British fashon), an shi tek as Im pen nem. Afta wen MacEdward Leach don get a Bashelor digri for 1916 an wey don komplit Im militri Davis for Wold War1,Im an Maria kom Mari for 1917.Both of dem muv go Baltimore wia bot of dem kom stat graduet stodi for Johns Hopkins. Maria kontiniu to dey stodi for doctorate for folklore for 1918-19. For 1920, Im enta di Yunifasiti of Pennsylvania for Philadelphia an kom stat to dey tish as instrokto of Inglish. Afta som time, for 1924,Leach dem kom bikom peret of one boi-pikin, Macdonald,wsh bi dia onli pikin. As e bi sey e jus bikom yong fada, MacEdward Leach kom get im doctorate for Inglish for 1930 an e kom join di fakoti of di Yunifasiti for 1931 as asistan Profeso of Inglish.

Leta Life an Profeshona karia

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1936, Maria Leach kon dey work for di Funk an Wagnalls.Na dia ofis wey de Philadelphia e de. Funk an Wagnalls na one kompini wey dey poblish buk for skul. As a peret wey dey wok, Leach an e hosband kom get Haus for Bucks County Pennsylvania. A Afta som yia wen dia boy-pikin dey for boardingskul, Leach an im hosband kom stat to de do dia indipendent wok dem. As im stil dey for Pennsylvania, shi muv go back to New York,