Margaret Bane

From Wikipedia

Margaret Bane ( wey dey bon 1542 an e kpai March 25, 1597) na Scotland wuman wey dey tekia of wuman wey get belle an wan bon. E dey pat of di pipul wey dey kill for di Great Scottish Witch Hunt of 1597. Na for Kincardine O' Neil, Aberdeen, Scotland Margaret Bane dey stey wit e hosband. Bane an e hosband bon two pikin, Duncan Gardyn an a gel kol Helen Rogie. Dia two pikin dey stey with dem. Na to dey tekia of wuman wey get belle bi Bane wok an pipul respet am wel wel. Meni pipul dey kom mit am for tritmet from pipul wel no too get moni to big wuman dem. Pipul hakuss am sey na juju wuman or witch for in 1567 but na 1597 dem kom joj am for Kot. Dey Kil Bane for di sem year.

Wetin hapun for e kot kess[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 1567 dey fest hakuss Bane of witch bikos e dey du tins wit e frend Jonet Spaldarge wey bi e sista. Notin du am onti di "Great Scottish Witch Hunt of 1597". Na hakuss am sey e na witch in 1596 but dey leave am. Eight wuman tok sey e dey among dem as dem dey yuz juju on odas. Bikos di wuman-dem dey live an wok togeda, so e dey hisi for dem to no one anoda inside kot. Dey hakuss Bane of meni tins. One of di tins bi sey e dey du tins wit a witch wey bi e sista Jonet Spaldarge an how kom e too sabi tins abaut wuman belle. Pipul stil hakuss am sey na e kill e forma hosband. Dey tok sey e du am by di transfa of di labor pain wey one wuman give am.Anoda tin wey dey tek hakuss am bi sey e no grit one man way grit am bak one day an di man kpai dat sem day. Dey sey Bane na witch bikos e go luk go majik way happun for sea side an sey how e tek no sey one pikin go bi boy or gel.

Bifor Bane kpai, e tok meni wuman sey dem sef na witch an some of dem na: Christiana Arcly, Jonat Davidsone, Jonat Lucas, Margrat Og, Issobell Oige, Isobelle Richie, Beatrix Robbie an Bane own pikin sef Helene Rogie.