Marcelle Lively Hamer

From Wikipedia

Elizabeth Marcelle Lively Hamer (dem bon am for July 14, 1900 an e kpai March 4, 1974) na Amerika Labrarian an e dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way. E wok for ova 30 years at di Yunivasiti of Texas an di El Paso Poblik Labrari. E dey wok as espat in Texas tradishonal tori an histri. Hamer wok for 17 years as person wey dey kip dia moni for Texas Folklore Sosaheti.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Whitewright, Texas dey bon Elizabeth Marcelle Libely on July 14, 1900. E papa nem na Robert Morris an e mama nem na Clara Susan (Lemon) Lively. Hamer papa a pesin wey dey sel big goods an banka. E mama na Inglish tisha for Grayton Kolej. Hamer yuz one year at di skul wey rilijon sista dey kontro Kidd-Key Kolej bifor e kom go finish e sekondri skul for Southeastern Stet Normal. In 1919, Hamer get a two-year digri from Kristen Kolej. For di Kolej, e bi dia studet union presidor. Hamer kolet e Bashelor digri in Inglish from di Yunivasiti of Oklahoma in 1921. E leta get e Masta digri from di Yunivasiti of Texas in 1939. Di Pepa wey Hamer wok wit na "Anecdotal Elements in Southwestern Literature". In a 1943 Life Magazine wey tok abaut Texas tori, na Hamer Pepa dey tok sey pipul rid pass in di hol of Yunivasiti of Texas koleshon.

Hamer mari e hosband Robert Colt Hamer in 1922. Di marej produs one gel-pikin, Mary Marcelle Hamer Hull. Hamer marej skata in 1930.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hamer wok as di daretor of di Texas koleshon at di Yunivasiti of Texas from 1935 go rish 1955. Hamer dey yuz di big "Battle Hall reading room" as e ofis. El Paso Poblik Labrari give am wok sey mek e bi di Refirens assistant in 1955.