Manchester Pusher

From Wikipedia

Di Manchester Pusher na di nem wey pipo dey give one pesin wey pipo jos emajin sey e dey kill meni pipo. Pipo emajin sey, na Manchester Pusher dey kill all bi dead-bodi wey dem don see for inside kanal wey de "Greater Manchester", England since 2007. Meni pipo wey bilif dis tori tok sey di nomba of dead-bodi wey dem see for Rochdale, Ashon, an Bridgewater canal sins earlier 2000 don pass wetin we fit tok sey na dos pipo kom kill diasef for dis aria. Dem bilif sey na Manchester Pusher kill dem. Bitwin 2008 an 2016, Pipo diskova ova 60 dead-bodi for "Greater Manchester canal". Di Polis-dem wey de "Greater Manchester" don do evri tin wey dey fit do to esplen sey notin like Manchester Pusher for dat aria. Di Polis kom up with difren difren tori to fit esplen di risin why dead-bodi plenti for dat aria. But pipo still no gree for di esplanashon wey Polis dey give pass