Man-eating plant

From Wikipedia
Man-eating plant
Subclass ofmythological plant Chenj-am
Main food sourcepesin Chenj-am

Man eating plant na one plant wey dey big an fit kil pesin an big animal. Difren tori an tok don dey abaut am for di wod.

Di Madagascar tree[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di stat of di Man eating plant fest stat as tori wey dey buk wey Edmund Spencer for di New York World. Spencer artikul fest sho for daily Edishon of di New York World on 26 April 1874, kon stil sho for di evri day niuspaper of two days afta. Insaid di artikul, dem rait letter by one German pesin, wey im nem bi "Karl Lache" (wey dem rait as Karl or Carl Liche for im niu akount), wey tok abaut repot of hau "Mkodo tribe" of Madagascar dey du skrifais. Plenti niuspaper Kari di tori tu, South Australian Register of 27 October 1874, wey dem uze sabi am wel wel. of hau "Mkodo tribe" of Madagascar dey du skrifais. Plenti niuspaper Kari di tori tu, South Australian Register of 27 October 1874, wey dem uze sabi am wel wel. wey tok abaut repot of hau "Mkodo tribe" of Madagascar dey du skrifais. Plenti niuspaper Kari di tori tu, South Australian Register of 27 October 1874, wey dem uze sabi am wel wel. of hau "Mkodo tribe" of Madagascar dey du skrifais. Plenti niuspaper Kari di tori tu, South Australian Register of 27 October 1874, wey dem uze sabi am wel wel.

Di tori wey plenti pipu don bliv kon dey popula for Madagascar: Land of the Man- eating Tree, na buk by Chase Osborn, wey bi bifor bifor Govnor of Michigan.Osborn klaim sey di pipu an missionaris wey dey Madagascar sabi wia di tree dey. Wey mek am gree wit wetin Liche tok, an e kon gree as e tok sey e no kno weda di tree dey tru tru abi na just tori wey dey for long taim. But wetin dey mek am hapi bi sey e don mek di tori mek pipu abi plez wia pipu no kno bifor.

Insaid im 1955 buk, Salamanders an oda Wonders, science buk raiters, Willy Ley rait sey di Mkodo tribe, Carl Liche, an di Madagascar Man -eating tree tori no rili dey tru tru, na jus wetin som pipu sidon tink.

Yateveo[chenj-am | chenj-am for orijin]

Insaid James W. Buel's Sea an Land (1889), Di Yateveo plant na wetin dey kommon for Afrika an South Amerika, dem sabi am as wetin dey produs sounds lik sey pesin dey hiss an e resembu word ya te veo (lit. 'I don ci you'), an e get poison lik crow crow animal wey dey vex, e dey wound an kach plenti animal wey kom klose to am.

Di Vampire Vine[chenj-am | chenj-am for orijin]

William Thomas Stead, wey bi editors of Review of Reviews, do one smol wok in October 1891 wey tok tori wey dem ci for Lucifer Magazine, wia e kol one plant for Nicaragua Devil trap, di plant get pawa to draw animal wey dey pas an finish dia blood.

Na leta leta dem du faindings of Stead review dem ci sey no wok wey e du for October wey bi lik day, an kon tok sey di tori na wetin pipu siddon plan du.