Malaria

From Wikipedia

Malaria na one disis wey Moskito dey korse wey dey hafet pipul an hanima.Malaria sikness dey mek pipul get Fifa, dey taya, dey formit an hed go dey pain pesin.If di Malaria don strong for bodi, e dey korse mek pesin eyes for faze dey yeelo, bodi go dey shek, pesin fit enta koma an pesin fit kpai sef.Di sahin sey pesin don get Malaria for bodi dey sho afta ten days or fifteen days wey Moskito wey get Malaria don bite pesin. If pesin no kwik tek medisin di malaria fit no komot for bodi an pesin fit dey get malaria ova an ova afta som month. If pesin don get di malaria bifor bot e don wel an anoda malaria kon enta di bodi again, di sahin no go strong like di fest time wey e get di malaria. Na one smol taini hanima wey pesin neked eye no fit see wey pipul dey kol "Plasmodium" dey korse Malaria.Na fimale Miskito wey bi "Anopheles moskito" dey korse Malaria. Dis moskito go bite pesin kom yuz e mouth put salava into pesin bulod.Di smol hanima wey dey inside di salava go enta di bulod kom waka go di liva wie dey go sit down an bon pikin dia.Di smol hanima wey eye no fit see wey dey korse Malaria na five type. Di type wey dey kil pass na "P.falciparum" bet odas like "P vivax, P.ovale an P.malariae" go jost mek pesin sik smol.Di last type "P.knowlesi" no too dey kach pesin like dat.

How bodi dey sho sey Malaria don enta am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Man an Wuman wey get Malaria go dey feel kold an fifa.Di pesin go dey suwet, hedik go dey wori am, e go dey taya, belle fi dey wori am an mosu go dey pain am. Smol pikin own na to feel fifa, na koffu, dey vomit an dey shit enihow. Di Malaria wey bad pass na di one wey don enta brain wey Oyinbo dey kol "Cerebral malaria" an na P.falciparum dey korse dis one. Pesin go dey feel am sey dis kind Malaria don enta bodi afta 9 to 30 days wen moskito don bite pesin. Di way wey pupil go tek sabi sey pesin get dis malaria na sey pesin gi dey waka like kraze pesin, pesin no go fit stand wel, di two eye go dey dans go difren dareshon, pesin go dey shek an pésin fit enta koma ( pesin dey bitwin life an death).

How malaria dey stat for bodi[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na one smol hanima wey bi "Plasmodium" wey moskito dey kari inside dia salava mouth dey korse Malaria for pipul.Dat Plasmodium na five type:

  1. P. falciparum
  2. P. malariae
  3. P. ovale curtisi
  4. P. ovale
  5. P. vivax
  6. P. knowlesi

Na P.falciparum type plenti pass an folo by P.vivax. For Afrika, na P.falciparum dey kach us pass bot for outside Afrika na P.vivax.

Test to komfam sey pesin get malaria[chenj-am | chenj-am for orijin]

For ples wey malaria dey too kach pipul Wold Helti Organisashion (WHO) tok sey pesin wey get fifa or wey e bodi dey hot pass 37.5°C fit get malaria.Smol pikin wey e hand dey yelo or test wey dey du for lab wey sho sey haemoglobin levu don go down pass 8 gram per deciliter of bulod fit sho dey di pikin get malaria. For lab, pesin bulod wey dey put inside mikroskope dem dey tek test weda pesin get malaria.For aria wey mikroskope no dey na one tin wey Oyinbo dey kol RTDs (Rapid Antigen Test) dem dey yuz.Di pesin go yuz nidu chuk e hand kom put e bulod for di RTDs kit an di tin go sho if pesin get malaria or not.

Wetin pesin fit du mek e no get malaria[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • tek medisin wey fit komot malaria for bodi
  • Kil moskito eniwie you si Dem
  • No grie mek moskito bite you
  • Tek vasin for malaria (wey bi RTS,S)
  • No stey wie pipul plenti wel wel